'My oga husband abuse me in so many ways, sexually, emotionally, physically' - Nigerian woman tok of slavery and rape for UK

Modern slavery victim for one anonymous interview
Wetin we call dis foto, Rose tell BBC say her "life na hell" wen she come Britain

As she siddon for di living room of one Salvation Army safe house for Cambridgeshire, Rose look like a regular 20-something. Her clothes and friendly smile reveal little of di four-year ordeal wey bring her from Nigeria to dis refuge.

She say her dreams of a new life for Britain don become nightmare of punishing work, physical assault and rape. She dey fear to tell her tori, but want make pipo understand di reality of modern slavery for di UK - crime wey dey plain sight.

Rose comot from Nigeria full of hope for all Britain get to offer.

She be di first of five children, her father na trader until e lost im shop, wey make di family no fit continue to pay for her education.

So wen one family friend from church tell her of one ogbonge opportunity to become nanny for one wealthy UK couple, wey go sponsor her studies, she jump at di chance.

She travel go UK on a six-month tourist visa.

Wen she first meet di couple, she say dem look "nice" and dem give her one room for dia bed apartment, but she soon discover say dem no advertise di job.

Generic foto of one woman wey dey look outside indow

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rose say she dey stuck inside hours dey cook and clean every day

Rose, no be her real name, say dem bin carry her go one restaurant wey di couple get, she go cook and clean from 17:00 to 05:00.

She bin dey work six days a week, and on her only day off, plenty work dey for her to do for house.

"I feel so exhausted... so empty. Dis no be wetin dem promise me, she tok.

Rose say di tough work pattern bin continue for one year, wit no wages and no sign say she go start school.

"Dat na wen e dawn on me say - 'Oh, these pipo really bring me here to work for dem as slave.'"

At di time she no fit call her family sake of di CCTV wey dey di house, na wen she take di couple little girl go park, she fit call.

Even den, she no dey tell her family wetin she dey face.

"Wen I call [my mother] and she ask me, 'How you dey?' - I go lie give her. 'I dey fine, I dey OK, dem dey plan send me go school.'"

She say di couple go shout for her, dem go call her "stupid" and "useless", wey make her "very scared".

For one occasion, she say di wife bin slap her for one perceived act of disobedience.

'My life na hell'

Salvation Army shop for Cambridgeshire

Wia dis foto come from, Dolly Carter/BBC

Wetin we call dis foto, Volunteers for one Salvation Army shop make welfare packs for survivors of modern slavery

Di Covid-19 pandemic make matters worse.

All di oda staff leave di restaurant, dem leave only her to dey cook and clean all night.

Di wife also go back Nigeria, wey leave only Rose to take care of her daughter.

As she describe her routine, she say na only few hours she dey get to sleep each day, Rose begin cry.

She say di situation trap her and expose her to a new form of exploitation.

"Di man abuse me in so many ways. Sexually, emotionally, physically.

"E rape me countless times because I no fit follow anybody tok.

Her escape come wen she confide in a friend for di restaurant, wey bin don dey tell her to report to police.

At first, she bin no wan do am becos di couple make her fear di authorities.

"I no get dat confidence anymore becos I no see myself as good enof, I no see myself as human being."

E no come as surprise to Rose say di pipo she dey work wit, and di customers she dey serve, no get idea of wetin she dey go through.

"I see pipo every day, dem see me laugh and smile. Inside I dey cry."

Kathy Betteridge, Salvation Army

Wia dis foto come from, Dolly Carter/BBC

Wetin we call dis foto, Kathy Betteridge, one director of anti-trafficking for di Salvation Army, tok say modern slavery cases dey on di rise

Rose tori dey familiar to di Salvation Army - di charity wey hold goment contract for supporting victims of modern slavery since 2011.

To offer economically disadvantaged pipo dream job or educational opportunity na common method pipo dey use trap dia victims, wey dey told say dem owe dia captors dets and must work to pay am off.

Territorial director for anti-trafficking, Kathy Betteridge, tok say in spite of increased awareness, many pipo still dey fall as mugu.

"For every one pesin we don rescue, seven odas still dey for captivity," she tok.

Di charity calculate say dem don support 22,000 survivors and di numbers dey grow evri year.

Last year across England and Wales, dem rescue and support 3,533 pipo, while for di East of England, di charity help 187 pipo - increase of 64 pipo from di previous year.

'We give dem dia life back'

Forced labour dey common for di construction, agriculture, hospitality, domestic and sex industries, she tok but "growing concern" dey about di care sector.

"Dem no use chain bind pipo wey dey inside modern slavery as some pipo fit dey tink.

Signs to look out for and report include pipo wey dey fearful or withdrawn, those wey get marks on dia bodies or appear to be controlled by pesin wey dey tok on dia behalf.

Rose bin don receive initial decision from di Home Office to say "reasonable grounds" dey to say she be victim of modern slavery but dem dey await "conclusive grounds" determination, wey fit take many months.