Nigerian wey allegedly kill im wife afta relocating to UK go remain for detention

Olubunmi Abodunde and im wife Taiwo

Wia dis foto come from, Owoeye Alex Adekunle/Facebook

Nigerian man Olubunmi Abodunde wey dey face accuse say e murder im wife, Taiwo Abodunde for United Kingdom no enta any plea as e appear for Suffolk Magistrate Court and Ipswich Crown Court.

Suffolk police for UK say Abodunde wey be 47-year-old go remain for police custody for further hearing.

Di news of di death of one nurse, Taiwo Abodunde begin spread on Tuesday, 28 November afta her brother, Owoeye Alex Adekunle on behalf of dia family share di post of her death on im Facebook page.

Oga Owoeye tok say UK police afta investigation don declare Olubunmi Abodunde as di sole murderer of im wife, wey be dia sister.

“According to Suffolk Police, afta thorough investigations, despite been caught in di act, don declare di husband as di sole murderer of im wife (my sister).”

E tok say di deceased leave behind three children and currently dem dey in di care of UK social services.

Police don seal outside one property on Exning Road

Wia dis foto come from, John Fairhall/BBC

Wetin we call dis foto, On Tuesday, police bin enta di property on Exning Road at 09:55 GMT
Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Earlier, Suffolk police for inside statement bin tok say dem receive report of one serious incident for one property for Exning Road for Newmarket Suffolk around 9.55am and by di time dem reach dia, dem discover di deadi-body of Taiwo Abodunde.

Di detectives say dem arrest two men, her husband plus anoda 38-year-old man as suspects for murder and dem carry dem go Martlesham Police Investigation Centre for questioning.

Afta investigation, police say dem charge oga Abodunde, di only suspect wit murder and dem release di 38-year-old man and e no go face further action, detectives tok.

Suffolk Constabulary say dem don carry di case go di Independent Office for Police Conduct (IOPC).

Police close di area on Exning Road and increased police presence go dey di area, di force tok.

One tok-tok pesin for di IOPC tok say: "We fit confam say we don receive referral from Suffolk Constabulary in relation to dis incident and we dey carry out assessment to determine what further action go dey required from us."

Meanwhile Suffolk police say make anybody wey get correct information wey fit help di case come forward.