How more dan 17,000 asylum seekers take disappear for UK

Wia dis foto come from, Getty Images
Home Office officials don admit say dem no know di whereabouts of more dan 17,000 asylum seekers.
Dis number bin emerge wen di MPs bin dey how Prime Minister Rishi Sunak dey target how to eliminate di backlog of asylum by di end of di year.
Di Home Office don already withdraw thousands of asylum applications afta doz wey dey claim am fail to respond.
One senior official bin tell di home affairs select committee say dem no know wia diz asylum seekers dey.
"I no think say we sabi wia all diz pipo dey."
Wen dem ask if some of di pipo don return go dia home kontris, Simon Ridley wey be senior civil servant for di Home Office say im no know.
Why committee dey withdraw asylum claims
According to wetin officials bin tell di committee, dem dey withdraw claims of asylum seekers if dem fail to respond to two successive case worker interview requests or questionnaires.
Na since December last year dis bin don happun about 17,316 times. For 2021, na about 2,141 applications dem withdraw and na about 24,403 dem refuse for 2004.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wen dem withdraw any application, e mean say e no longer dey under consideration and if di pesin wey dey claim asylum remain for UK dem dey illegally and dey fit comot dem.
Figures wey comot last week say di number of cases for di "legacy backlog" na 39,668 for di end of September. Dis dey relate to asylum claims wey dem make bifor June 2022.
Di most senior civil servant for di Home Office, Sir Matthew Rycroft say di goment always dey confident say e go reach di target wey di prime minister set and dem don hire more case workers wey go assess claims of asylum seekers.
But Conservative MP Tim Loughton, wey dey di selection committee say e dey strange say pipo no dey continue wit dia claims.
" E dey strange say wen we dey face very stiff target, we get three-fold increase for di undetermined reasons why pipo no dey move forward with dia claims?"

Wia dis foto come from, Getty Images
Why UK wan send asylum seekers go Rwanda
UK officials don dey under pressure to reduce di backlog as di goment dey continue wit plans to send asylum seekers go Rwanda.
Sir Matthew tell MPs say officials go Kigali capital of Rwanda to put "finishing touches" to di tok afta di Supreme Court don rule say di plan dey unlawful.
Di court say risk dey sake of say dem fit return asylum seekers wey dem go send go dia back to dia home kontri and dis fit break di UK and international human rights laws.
Di Home Office dey negotiate a treaty wey Rishi Sunak say e go satisfy di concern of di Supreme Court say Rwanda na safe third kontri.
Di goment say di policy go prevent pipo to dey use small boats to cross di English Channel. Na about 28,072 pipo don cross di English Channel through small boats as of 28 November 2023.
Questions of how much di goment don already pay Rwanda begin dey comot, afta dem tell di MPs say e go reach months bifor dem go learn say e go pass di £140m wey dem tok bifor.
Sir Matthew say dem fit pay more but e no fit say if dem don make any additional payments. E say di ministers don decide say dem no go reveal dat information until e reach di summer.
Chairwoman of di committee Labour MP Dame Diana Johnson say dis response make am ‘difficult to scrutinise di flagship policy of di Home Office and how much dem don spend sake of say na end of di year dem go get di figures.’
How many migrants dey come to di UK?
For June 2023, 1,180,000 pipo go di UK as dem dey expect to stay for at least a year. Na about 508,000 pipo depart same year.
E mean say di net migration wey be di difference between di number of pipo wey dey arrive and comot for di UK na 672,000.
Dis mean say e drop from dat of 2022, wia di net migration reach 745,000 pipo.
Data show say majority of pipo wey dey arrive di UK na from kontris wey dey outside di European Union (EU).
Latest figures show say na 968,000 pipo dey come kontris wey dey outside EU.
Na 39% pipo dey go UK sake of study, 33% dey go sake of work and 9% dey go sake of humanitarian reasons, according to di office of di national statistics.
Di top five non-EU nationalities na:
Indian (253,000)
Nigerian (141,000)
Chinese (89,000)
Pakistani (55,000)
Ukrainian (35,000)














