Nigerians wey wan japa reason next move as UK release data on student visa

Photo of Nigerian passport

Wia dis foto come from, Getty Images

United Kingdom State for Home Office Department don block international student make dem dey bring dependants come dia kontri.

In May 2023, di United Kingdom under di former interior secretary Suella Braverman, restrict international students wey wan travel wit dia family to United Kingdom from January 2024 - di new law say na only PhD students fit bring dia family.

Braverman bin say di policy na to reduce di number of dependants wey dem go dey issue visa come United Kingdom evri year.

Recently, di United Kingdom goment release data say Nigerians get 60,506 wey be di highest number of international students dependants for dia kontri from 2019 to September 2023.

Dis one don make Nigerians begin reason oda ways to take get visa for dia family make dem legally enta United Kingdom.

"Di tin don come be like say e don hard more. Di process to enta UK last year don dey totally different from wetin dey happun now," Mojeed Jimoh tok.

Jimoh, wey be age 28 dey plan to go do post-graduate course for one UK university afta im compulsory National Youth service for Nigeria say di money wey im bin save for di waka no fit do am again.

E say "my hope to fit travel now wit my wife go delay small becos I need to save more money."

Informate about how to japa plenty for internet but di process still dey confuse many plenty pipo.

Di one wey pipo dey wan easily use na di student visa wey fit allow pesin carry na wit student visa for foreign masters students and dia famly.

Oda legal ways wey you fit carry your family or start your family for UK.

  • You fit migrate through work visa.
  • You fit migrate through through family visa.
  • You fit migrate throughinternational student visa (PhD only).
  • You fit migrate throughUK investment scheme.

Migration through work visa na di most popular visa afta student dependant visa. As a skilled worker wey dem dey reqiure your skill for UK, you go need employment visa sponsorship so you go fit to work for UK and carry your family come as you don travel faraway from Nigeria.

Di qualification for dis visa na to check UK job websites for di kain job wey dey available for dia kontri especially jobs wey get shortage of employers like health care services, finance, teaching, engineering, artist, graphics designer and technology. Also, you go need work permit and check if your company fit hire you wit dia lincense. Odas include; proof say you sabi English language, international passport, annual salary and job title.

To apply for your family especially children (under age of 18) and partner to join you as dependant. You go need to apply separate visa application for dem under your own application becos all di application go expire wen your own work visa expire. You need prove say dem be member of your family and una don dey live togada for two years.

Also, migration through family visa dey among ways you fit live for UK for a long time but you gatz be partner or pikin of UK citizen, marry British citizen, join di UK military or marry pesin wey get UK settlement visa. You fit apply as pikin under di age of 18 and partner or fianance wey don dey marry di pesin or plan to do wedding in di next six months.

Afta, UK goment restrict visa for families of foreign UK masters student, di goment still allow families offoreign PhD students to apply for visa. PhD students visa dey among di points student visa but di pesin wey dey do di doctorate program must show say im dey do research wey dey relevant to UK and im family dey live faraway.

Anoda one na migration through UK investment and innovator scheme wey you go fit apply for di investor visa under three months bifor you go fit travel to UK. You go need £2m funds (2bn naira) wey you go deposit for UK bank for some years bifor you and family fit legally relocate enta UK.

To dey qualify for di innovator visa, you go need get £50,000 (50m naira) investment and innovative business idea wey go help grow di kontri economy.