Canada release three year plan for new permanent residents wey go start 2024

Canada flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Immigration, Refugee and Citizenship Canada don release details of di goment plan for pipo wey wan become residents for di kontri for di next three years.

Di immigration levels plan for 2024 reach 2026 go give 485,000 pipo new permanent residents for 2024, 500,000 for 2025 and e go reach im maximum target of 500,000 for 2026.

Di group of pipo wey dis plan go consider according to di informate wey di goment put for dia website na economic immigrants, families and pipo wey dey suffer sake of humanitarian reasons.

“For 2024, Canada dey look to welcome about 281,135 immigrants under di economic class, or 58% of di annual target. By 2026, dis go increase to 301,250 immigrants, or 60% of di annual target.”

Dis particular plan according to di Canada goment go make am priority to support families wey bin dey separated to reunite among oda tins wey dem target to achieve.

Pipo wey dis plan dey also target most na high skilled workers and caregivers, especially di ones wey fit provide care for children and for pipo wey need high medical needs.

Dis one mean say anybody wey wan japa go Canada, must be skilled worker and caregiver or already get family for dia.

Verify university acceptance letters

pesin leg for side of canada flag wey dem paint for road

Wia dis foto come from, Getty Images

Earlier for di week, Canada Immigration minster give informate say di kontri go step up how dem dey take verify university acceptance letters to prevent immigration by fraudsters wey wan scam international students.

Marc Miller tell dis one give tori pipo on Friday say di student immigration get plenti frauds and "perverse incentives inside".

Earlier dis month, di mata of fraudulent admission letter bin come take center stage wen plenti foreign students collect deportation letters say dem use fake document take enta Canada.

Canada na popular destination for international students becos say e dey easier to get work permit for dia.

So wetin go come happun to international students now?

Well from December, Miller say evri tertiary institution go need confam applicants letter of acceptance wit di Canadian immigration authorities gan gan.

Canada also get plans to arrange wetin dem dey call "recognized institutions" list for 2024 wey go show international students di schools wey dem go fit get beta services from like housing and oda supports.

Na those institutions go get faster student permit for di application processing.

Miller tell tori pipo say, "wetin we dey see na business model wey dey find short term gain without looking at long term pain and we need to turn dat trend around."

Canada dey depend on immigration to help move dia economy and support dia population wey don dey old dey go. Prime Minister Justin Trudeau don dey ginger di annual immigration.

Man for immigration counter

Wia dis foto come from, Getty Images

Di goment say international education dey make ova C$22 billion ($15.9 billion) of di kontri yearly economic activity. E dey also support ova 200,000 jobs.

Official data show say for 2022, e pass 800,000 international students wey bin dey Canada for 2022 and dem dey expect di number to pass 900,000 for 2023.

Tori pipo for Bloomberg bin report say concern dey rise say Canada educational institutions dey depend too much on international students as source of funding.

Foreign students dey pay average of five times wetin Canadian students dey pay and allegedly colleges for foreign students don dey open everwia.

For di kontri largest province, Ontario, tori be say dem don freeze di tuition fees wey Canadian students dey pay.

So in 2021, international students pay about 68% of school fees for di colleges for Ontario.

But, for many foreign students, college admission na way to take get permanent residency for Canada.

Miller, for im press conference bin dead di idea say goment wan put cap o top di number of international students visa dem dey give out.

Dis na as polls for Canada dey show say pipo don start to dey worry of di amount of pipo wey dey enter di kontri on top dis immigration mata on top di housing crisis.

Miller say, di experiences of international students dey too complex for federal foment to "match enta and pretend say dem get all di solutions" come chook visa cap.