Places wey Lagos state govment warn pipo to move from sake of flood

Flooded street
Wetin we call dis foto, Place wey flood take over for Lagos
Read am in 4 mins

Lagos state govment don warn residents wey dey stay for flood prone areas make dem move to higher grounds, say more floods dey expected sake of di raining season.

Di state Commissioner for Environment Tokunbo Wahab on Tuesday while e dey speak wit Channels Television list some of di low-lying areas wey flood fit hit any moment and tell di communities to act sharp sharp to avoid disaster as di rains still dey come.

Dis dey come as flood hit some parts of Lagos on Monday, 5 August, afta one all night rainfall across di state and neighboring states.

Some pipo wey dey affected by di floods enta social media to post videos of di houses and property wey di flood affect.

For one of di videos, one woman dey use bucket pack water comot from her sitting room. For anoda video, di flood grow reach half of di houses of di victims. Di videos also show cars and streets wey floods take over completely.

According to di commissioner, govment dey try dia best to ensure say di effect of di floods no go dey too harsh, say dem dey open up gutters and gullies.

Di commissioner mention areas wey dey at risk as:

  • Some parts of Lekki
  • Some parts of Ikorodu
  • Ajegunle
  • Ajilete
  • Majidun
  • OPIC estate

E say areas like Epe, Mushin and Ikeja dey safe for now.

Lagos na city wey dey sit ontop water and dey surounded by water, sake of dis di state dey prone to flood especially wen plenti rain fall.

States wey rain and flood go affect according to Nimet

Property of pipo wey flood pursue
Wetin we call dis foto, Pipo wey flood pursue for dia house for Lagos

Meanwhile, di National Flood Early Warning Systems Centre for Federal Ministry of Environment Nigeria on Tuesday bin forecast say five days heavy rainfall go hapun and fit trigger flooding for 19 states and 76 locations for di country.

Di states include Akwa Ibom, Bauchi, Ebonyi, Cross River, Nasarawa, Benue, Kaduna, Taraba, Katsina, Kebbi, Kano, Borno, Plateau, Niger, Jigawa, Yobe, Zamfara, Sakoto and Gombe

Nigeria Meteorological Agency Nimet bin send out rain and flood warning to some states of di country and mention say Lagos go witness more rainfall dan wetin hapun for 2023.

According to Nimet, states wey go witness heavy rainfall include Lagos, Delta, Bayelsa, Cross River, Rivers and Akwa Ibom states. Dem say di rains go last between 250 to 290 days.

Nimet say Ogun, Oyo, Ekiti, Osun, Ebonyi, Anambra and Enugu go experience 200 to 250 days of rainfall.

For northern Nigeria, di rains go last between 110 to 150 days for Sokoto, Katsina, Zamfara, Kano, Jigawa, Yobe and Borno states.

Oda times wey flood cause gbege for Nigeria

For 2019, flood from rainfall destroy properties and take over homes of plenti pipo for di Isheri - Opic axis of Lagos, plenti pipo no fit access dia homes while few wey no get option use wooden canoe to enta dia house.

For 2024, Iyana-Oworo and Olopo Meji areas wey be di main entry point for Third Mainland Bridge bin dey seriously flooded, e cause heavy traffic down to Alapere.

Some road users dat time tell BBC News Pidgin say dem bin spend over four hours from Alapere to di domot of di 3rd mainland bridge.

Flood dey hapun across Nigeria and oda parts of Sub-Saharan Africa during raining season, di effects most times dey dey deadly and pipo dey lose plenti property to di floods.

For July 2025, at least 23 pipo don die for Adamawa State for Northern Nigeria and many odas injure afta heavy flood sweep several communities for Yola North and Yola South Local govment areas of di state.

Di heavy rain start before day break and reach continue till di next morning, and e cause serious wahala for di affected areas.

Di recent disaster for Nigeria wey claim many lives and properties na for Mokwa local govment area wey dey for Niger state for northern Nigeria for May 2025.

Reports from authorities for Nigeria tok say more dan 200 pipo die while dem still say ova 300 pipo bin miss during di flooding wey hapun for May 29.

Di flood displace over 3,000 pipo in addition to houses and bridges e wash away for di state.

While also for September last year, Borno state for Northern Nigeria experience one of di worst flood disaster for 30 years for di state.

Di Borno flood also kill more dan 100 pipo and displace pipo from dia homes according to wetin authorities tok for Nigeria.