Trump sign bill wey order justice department to release Epstein files
- Author, Sakshi Venkatraman
- Author, David Willis
- Role, North America correspondent
- Read am in 4 mins
US President Donald Trump announce on Wednesday say e don sign bill wey order di release of govment files wey relate to di late convicted sex offender Jeffrey Epstein.
Di bill require di justice department to release all information from dia Epstein investigation within 30 days, although some fit dey withheld if dem relate to active investigation or fit invade personal privacy.
Wit Trump support, di legislation really clear both chambers of Congress, di House of Representatives and Senate, on Tuesday.
Afta e face pushback from Epstein victims and members of im own Republican Party, Trump change im opposition to release di files last week.
Until recently, Trump bin dismiss di need to release di documents, recently as e call am a Democrat-led "hoax" to "deflect" attention away from im party work.
"Perhaps di truth about dis Democrats, and dia associations wit Jeffrey Epstein, go soon dey revealed, becos I JUST SIGN DI BILL TO RELEASE DI EPSTEIN FILES!" e write.
Although a congressional vote no dey required to release di files - as Trump for order di release on im own - lawmakers for di House pass di legislation with a 427-1 vote.
Di Senate give unanimous consent to pass am upon arrival, and send di bill to Trump for im signature.
Di Epstein files subject to release under di legislation na documents from criminal investigations into di financier, including transcripts of interviews with victims and witnesses, and items wey dem seize for raids of im properties. Those materials include internal justice department communications, flight logs, and pipo and entities wey dey connected to Epstein.
Di files dey different from di more dan 20,000 pages of documents from Epstein estate wey Congress release last week, including some wey directly mention Trump.
Those include 2018 messages from Epstein wia e tok about Trump say: "I be di one wey fit take am down" and "I know how dirty Donald dey".
Trump bifor-bifor friend of Epstein for years, but di president say dem quarrel in di early 2000s, two years bifor dem first arrest Epstein. Trump consistently deny any wrongdoing in relation to Epstein.
Speaking to reporters on Monday night, Trump say Republicans get "nothing to do wit Epstein".
"Na really a Democrat problem," e tok. "Di Democrats bin be Epstein friends, all of dem."
Di family of Virginia Giuffre, wey die by suicide earlier dis year, tok for statement say Trump signing di bill dey "nothing short of monumental", for Giuffre and oda survivors.
"As we look towards di next chapter, we still remain vigilant. Dis work neva finish. Evri name must be revealed, regardless of power, wealth, or party affiliation," her brother and sister-in-law, Sky and Amanda Roberts, tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem find Epstein dead in 2019 for im New York prison cell for wetin a coroner rule as a suicide. Dem hold am on charges of sex trafficking. E previously dey convicted of soliciting prostitution from a minor in 2008.
Di once high-flying financier get ties wit a number of high-profile figures, including Andrew Mountbatten Windsor, di brother of King Charles and former prince; Trump; Trump former advisor Steve Bannon; and a cast of oda characters from di world of media, politics and entertainment.
On Wednesday, former Harvard president Larry Summers take leave from teaching for di university while di school investigate im links to Epstein, and reveal a series of chummy email exchanges.
Attorney General Pam Bondi dey required to release "all unclassified records, documents, communications, and investigative materials" wey dey related to Epstein and im co-conspirator Ghislaine Maxwell no later dan 30 days afta di law dey enacted. Maxwell currently dey serve a 20-year sentence for sex trafficking.
But based on di law text, portions fit still dey withheld if dem fit invade personal privacy or relate to an active investigation.
Di bill give Bondi di power to withhold information wey fit jeopardise any active federal investigation or identify any victims.
One of di bill architects, Republican Congressman Thomas Massie, say e get concerns say some files fit dey withheld.
"I dey concerned say [Trump dey] open a flurry of investigations, and I believe say dem fit try to use those investigations as a basis for not releasing di files. Dat na my concern," e tok.













