Trump dey call House Republicans to vote to release di Epstein files

US President Donald Trump tok to tori pipo for night

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Helen Sullivan
  • Read am in 5 mins

US President Donald Trump don ginger im own party say make dem vote to release files wey relate to di late convicted paedophile financier Jeffrey Epstein.

Trump bin write for Sunday night say make Republicans for di House of Representatives run am "bicos we no get anytin to hide".

Dis recent about turn dey come afta House Democats just dey do small drip feeding of di documents, some wey call Trump wey don always deny any kain link to Epstein sex abuse and trafficking.

But tori about im and oda big pipo and dia relationship wit Epstein don ginger tok-tok and lead to public fight-fight wit Trump most loyal supporters.

Potentially dozens of Republicans don sign say dem go break ranks and vote for di bill wey go ginger di US goment to publish all di documents for Epstein and di criminal investigations into am wey e get.

Supporters for di bill dey appear to get enof votes for am to pass di House dis week, even though e no clear weda e go pass for Senate, di oda chamber of di US Congress.

Dem bin find Epstein dead for im New York prison cell for 2019, for wetin one corona later call suicide. Dem bin hold am on sex trafficking charges even though e bin don dey convicted bifor say im bin dey solicit prostitution from minor for 2008.

Trump don follow di White House to call di attention to di Epstein files say na Demcrat-led "hoax" to shift attention away from di work im party dey work.

Trump write for im Truth social platform say, "di Department of Justice don alreadi release ova tens of thousands of pages to di public about 'Epstein' wey torchlight many Democrats (Bill Clinton, Reid Hoffman, Larry Summers, etc.) and dia relationship to Epstein and di House Oversight Committee fit get anytin wey dem dey legally entitled to. I NO CARE!"

E add say e want make Republicans "get BACK ON POINT".

Republican House Speaker Mike Johnson bin tok sometin like dat on Sunday, say di call to release di files bin be di opposition Democrats "full game plan".

Johnson tell Fox News say, "Trump get clean hands. E no dey worried about am. I dey follow am tok all di time. E no get anytin to do wit dis. E dey vex say dem dey turn am to political issue".

Since Trump bin enta di White House again, e don dismiss need to release more documents. Even though na one key demand wey many of im supporters and some of im key allies bin get.

Trump bin historically dey for inside pictures wit Epstein fr social events, but e don tok say e don seperate wit di financier years bifor Epstein 2008 conviction. E don also claim say e no sabi Epstein criminal activites.

Di US president about turn for di mata dey come afta Democrats for di House Oversight Committee bin publish three email echanges.

Di emails include correspondece between Epstein and im long-time associate Ghislaine Maxwell wey dey currently serve 20 year prison sentence for sex trafficking.

Some of those tok-tok make reference to Trump. For one email from 2011, Epstein write give Maxwell say "I want make you know say dog wey neva bark na Trump. [VICTIM] bin spend hours for im house wit am."

On Wednesday, di White House tok say di victim wey di email dey tok about na di popular Epstein accuser Virginia Giuffre.

No implications of any wrongdoing by Trump dey di emails.

Hours afta di emails comot, House Republicans bin publish 20,000 files to counter wetin dem say na Democratic effort to "cherry-pick" documents to try "create fake narrative to slander" Trump.

Both Democrats and some Republicans dey support legislation to release all di documents. Republican Representative Thomas Massie, wey be co-sponsor of di bill, tok for interview wit ABC News on Sunday say as many as 100 Republicans fit vote yes.

Di bill wey dem call di Epstein Files Transparency Act wan force di Justice Department to release all unclassified records, documents, communications and investigative materials wey bin dey linked to di paedophile financier Jeffrey Epstein.

Trump go still need to sign off on di release of di documents if e pass for both legislative chambers.

Wetin we call dis Video, White House: Epstein story 'a manufactured hoax'

For letter wey dem send to Congress, Epstein survivors and Giuffre family ask US lawmakers to vote so dem go release di files.

Di letter tok say, "remember your primary duty na for your constituents. Look di eye of your pikins, your sisters, your mamas and your aunts.

Imagine if dem preyed upon. Imagine if you yoursef na survivor. Wetin you enta for dem? Wetin you want for yourself? Wen you vote, we go remain your decision for di ballot box".

Di way Trump don handle dis mata recently cause public kasala wit Congresswoman Majorie Taylor Greene.

Di US president bin tackle am on Friday, as im call am "wacky" and a "traitor" and im suggest say dem go comot am for nest year election.

Greene come ask Trump weda im still dey put "America First" and e say e dey "make example" of am to scare oda Republicans away so dem no go vote for di bill.

But di US Justice Department don confan say e go investigate Epstein alleged links to major banks and several popular Democras wey include former US president Clinton. E don deny say e know anytin for Epstein crimes.

Di names of Hoffman, LinkedIn founder and one prominent Demcratic donor and Summers wey be Clinton treasury secretary both appeared compt for di recent release.

Summers don tok sorry ova say e bin get contact wit Epstein afta im conviction. While Hoffman don tok say wia im relationship wit di broker reach na to raise money for di Massachusetts Institute of Technology.