'Nobody see any phone tapping equipment for my papa house' – El-Rufai

Wia dis foto come from, BBC/ICPC/Facebook
New mata don sup ontop di case between former Kaduna State govnor, Nasir El-Rufai and di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC).
Tori be say ICPC say dem see phone tapping equipments for El-Rufai house wen dem search, but di family of di former Kaduna govnor say na lie say di commission no find dat kain equipment for di house.
Dis new kwanta dey come few days afta di former Kaduna State govnor, El-Rufai, though im legal team bin file N1 billion fundamental rights enforcement case against di ICPC ova wetin e describe as illegal invasion of im Abuja residence.
ICPC reportedly say dem search El-Rufai house wia dem recova some items wey include phone tapping equipments.
On 2 March 2026, El-Rufai son wey also dey represent Kaduna North Federal Constituency, Bello El-Rufai write on behalf of di family say wetin ICPC find for im papa house na old devices wey no be equipments wey dey tap phone.
El-Rufai son allege say ICPC cook up list of seized items wey dem wan use take claim say im papa dey tap phone calls.
All dis gbege begin dey get serious attention wen di Department of States Services (DSS) file three charges aganist El-Rufai for di federal high court for Abuja.
Dat na ontop one interview wia El-Rufai claim say im tap Nuhu Ribadu, di chairman of National Security Adviser phone call.
During di interview, El-Rufai claim say na Nuhu order im attempted arrest for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja, on 12 February 2026.
Also, inside anoda letter, El-Rufai bin claim say NSA import Thallium sulphate into di kontri and all dis allegations na im Ribadu don deny but dem dey investigate di former govnor, including di search for im house.
Wen ICPC bin search El-Rufai, im legal team ask di court make dem declare di search warrant "null and void" sake of say eno specify di kain items wey dem go seize, and for oda reasons wey dem claim say violate Section 37 of di constitution.
'Di list na fiction' El-Rufai son
"Dis list na work of fiction, for reasons wey go soon become known. Dis list no dey endorsed by Mallam El-Rufai or im legal representatives."
Dis na part of wetin El-Rufai son tok ontop di list of items wey ICPC say dem recova from di former Kaduna govnor house.
El-Rufai son confam say true true, di family dey dia wen di commission begin search di house wey dem seize some items.
Howeva, e say wetin ICPC find na olden days equipments and not phone tapping equipments.
"We dey wen dem seize dis items. No equipment oda dan old discarded personal mobile phones wey go back as much as 20 years, storage devices like flash drives and laptops, wey be standard possessions of any 21st-century citizen, wey dem seize from di property."
E add say di 'alleged "sophisticated tapping equipment" and "sensitive security documents" exist only for di imagination' of di ICPC.

Wia dis foto come from, Nasir El-Rufai/Facebook
Meanwhile, ontop accuse by ICPC say El-Rufai no corporate wit dia investigation, di son of di former govnor say di commission dey use im papa silence against am.
E say di Constitution of Nigeria evri citizen di 'right to remain silent' as per say na fundamental human right and no law enforcement agency fit use dat against any citizen.
"Di entire foundation of dis investigation don rotten. Di search wey uncova dis phantom items originate from one warrant wey legally get k-leg."
"We get credible evidence say di warrant na forgery wey dem fraudulently procure and present by one Magistrate wey dey sit for High Court of the Federal Capital Territory."
El-Rufai family accuse di ICPC say dia search warrant na forged one and dia lawyer don challenge am for court.
Dem say make di ICPC come ansa kwesions how Magistrate take get di 'jurisdiction of High Court to sign warrant wey dey based on false premises.'
"We don instruct our legal team to pursue all available legal remedies to challenge di illegal search, di forged warrant, and di defamatory statements made by di ICPC."








