Top military officers wey Boko Haram, ISWAP don kill for terror war

Top military officers wey Boko Haram, ISWAP don kill for terror war

Wia dis foto come from, Nigerian Army

    • Author, Daga Umar Mikail
    • Role, BBC News, Abuja
  • Read am in 5 mins

Tori come out on Tuesday say fighters of Islamic State of West Africa Province (Iswap) don kill Brigadier General Musa Uba for Borno State for northeast Nigeria.

Di killing cause plenty tok-tok about how jihadist groups like Boko Haram and Iswap dey still fit kill senior Nigerian military officers, even though no be first time officer go die for battlefield.

Report show say General Uba na di second highest-ranking officer wey gunmen don kill since 2021.

Iswap announce di killing for dia Telegram page, say dia fighters capture am on 15 November afta dem do ambush for Nigerian soldiers near Wajiroko town for Borno State.

Nigerian Army later confam di attack, say two soldiers and two vigilante pipo die. President Bola Tinubu send im condolence to General Uba family and oda soldiers wey die.

Dis article look di senior Nigerian military officers wey don die for di fight against Boko Haram since 2018.

Brigadier General M. Uba

Brigadier General Musa Uba

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Brigadier General Musa Uba

Brigadier General M. Uba na di commander of 25 Brigade for Nigerian Army.

Uba na di highest-ranking Nigerian soldier wey di group don kill since 2021.

Borno na one of di states for Nigeria wey dey suffer pass from attacks by jihadist groups, wia Boko Haram and oda factions dey control some areas.

Around mid-January, some Boko Haram or ISWAP fighters still attack farmers and fishermen for Dumba town inside Borno State for northeast Nigeria.

Majority of pipo wey dey live for Gudumbari, Marte and Abadam local govment areas don dey under di control of di gunmen for almost six years.

Brigadier General Dzarma Zirkusu

Since Boko Haram wahala start for 2009, Brigadier General Dzarma Zirkusu na di highest-ranking Nigerian soldier wey die for 2021.

Di General die wit three oda soldiers wen ISWAP fighters wey break away from Boko Haram ambush dem for Askira Uba for November 2021.

Di General, wey come from Adamawa State, becom commander of 28 Task Force Brigade for Chibok around January dat same year.

Statement wey Nigerian Army release dat time tok say dem succeed kill many of di gunmen and recover plenty weapons as dem take repel di attack wey dem launch against di soldiers.

Colonel Dahiru Chiroma Bako

Colonel Dahiru Chiroma Bako

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Wetin we call dis foto, Colonel Dahiru Chiroma Bako

For September 2020, Boko Haram fighters ambush Colonel Dahiru Chiroma Bako near Wajiroko town, and e later die from di injuries wey he get for di attack.

Reports tok say dem do surgery for am for 7 Division Military Hospital bifor e finally die.

E bin be commander of 25 Taskforce Operation Lafiya Dole for Damboa.

Borno State Govnor, Babagana Zulum, describe Colonel Bako as "one gallant soldier wey enemy nor ever fit capture Damboa under im leadership."

Colonel Muhammad Abu Ali

Colonel Muhammad Abu Ali

Wia dis foto come from, Nigerian Army

Wetin we call dis foto, Colonel Muhammad Abu Ali

Lieutenant Colonel Muhammad Abu Ali die for November 2016, one year after dem promote am from Major to Lieutenant Colonel.

Colonel Ali pass hundreds of him fellow soldiers bicos of di strong bravery wey e show for battlefield against Boko Haram as e dey command di 272 Task Force Battalion wey dey operate war tanks.

Na im unit fight one of di toughest battles against Boko Haram for February 2015, wey later make dem capture back Baga town from di insurgents.

Wen im death break, na one of di biggest gist for Nigerian social media dat time.

E die wen Boko Haram fighters attack Nigerian Army 119 Battalion for Mallam Fatori, Borno State.

"One moment e dey near tank dey hold him radio. But bicos everiwia dark, nobodi see di terrorist wey shoot am," one military hospital source tell TheCable dat time.

Lieutenant Colonel Ibrahim Sakaba

Lieutenant Colonel Ibrahim Sakaba

Wia dis foto come from, Nigeria Army

Wetin we call dis foto, Lieutenant Colonel Ibrahim Sakaba

Anoda gallant Nigerian soja we di kontri lose na Lieutenant Colonel Ibrahim Sakaba, we die for November 2018.

Dem kill Lt Col Sakaba during attack we gunmen carry out for one army base for northern Borno, wia dem also kill plenty Nigerian soldiers.

Before im die, na im be di commander of 157 Task Force Battalion for Metele.

For August 2021, Nigerian Army release statement deny wetin di soldier wife tok say na fellow soldiers kill am bicos he no gree join dem do corruption.