Tyler Perry dey face accuse of sexual assault and $260m lawsuit

Tyler Perry dey on di red carpet for one event. E wear one black suit wit one bow tie and e wear square glasses.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tyler Perry na one of Hollywood most successful actors, writers, directors and producers
    • Author, Christal Hayes
    • Role, BBC News, Los Angeles
  • Read am in 4 mins

One actor don sue US film and TV giant Tyler Perry for $260m (£194m) on top accuse say di media mogul sexually assault am as e dey work on im TV shows.

Derek Dixon bin file di lawsuit for Los Angeles and e accuse Oga Perry say e dey use im influence for di entertainment industry to create "forced, sexually exploitative dynamic" as im dey act on The Oval and Ruthless.

E allege say Perry bin promise am successful acting career but come subject am to "increasing sexual harassment, assault and battery, and professional retaliation" wen e no gree for Perry "unwanted advances".

Perry lawyer don deny di allegations and e call di lawsuit a "scam" to make money.

"Dis na pesin wey dey close to Tyler Perry for wetin now be like say e wan scam am," im attorney Matthew Boyd tell di BBC. "But dis lawsuit no go shake Tyler and we dey confident say these fabricated claims of harassment go fail."

Dixon say im meet Oga Perry for 2019 for one work event for Tyler Perry Studios for Atlanta, and di two of dem tok over several months about one acting career.

Di lawsuit claim say Perry also allegedly make numerous sexual comments and remarks say e want sexual relationship wit am, and e make several advances on Dixon – wey im reject.

Perry give Dixon one role for im show Ruthless, and for anoda movie, The Oval.

But di lawsuit say: "Mr Perry bin make am clear to Dixon say if Dixon ignore Perry or fail to engage wit di sexual innuendos, Dixon character go 'die' for di next season."

Di case claim say Perry "dey always hold dis mata ova Mr Dixon head, wey imply say [im character] 'Dale' go survive if Dixon keep Perry 'happy'".

Di lawsuit cite plenty incidents wia Perry allegedly sexually assault Dixon.

Di actor accuse Oga Perry say e kwesion am ova im sexual interests for one trailer for di set of The Oval, bifor e push am to a wall and caress am. Dixon tok say im refuse di lovey-lovey and comot di trailer.

Dixon say to stop di continued harassment, im decide to leave im role on The Oval and refuse one job from Oga Perry to work as a writer.

Wetin we know about Derek Dixon

According to reports, Dem born Derek Alexander Dixon for Raleigh, North Carolina.

E study for Marymount Manhattan College and act for Terry Schreiber Studio for New York.

Derek Dixon dey popular for im role as Dale on The Oval and Ruthless.

E also be di co-winner of di 2016 Essential Theatre Playwriting Award.

E perform for plays wey include: The Lion in Winter, Romeo and Juliet, and The Boys In The Band and e also write some full-length plays, wey include: Homewrecker, Red Snow, Pictures of People, Work of Art, and Green Light. For 2015, e join Working Title Playwrights.

Dixon bin dey work for one event company wen e meet Tyler Perry for one party for 2019, and e offer am role on 'The Restless'.

E also get anoda role on 'The Oval', wia e play di character of Dale inside more dan100 episodes bifor e eventually quit di show.