Michelle Obama make case for abortion rights as Trump gada support from Muslim leaders ahead of US election

Wia dis foto come from, Getty Images
Former first lady Michelle Obama bin join Kamala Harris for Kalamazoo, Michigan, wia she tell di pipo wey bin attend di rally to "do somtin" ahead of di upcoming election on 5 November.
Obama, pesin wey Americans no too dey hear from, give speech wia she tell pipo make dem no sit around and complain - but instead go out go vote for di Democrats nominee, Harris.
Di former first lady tell voters to protect di kontri from di "dangers" of Trump, and also warn how di Trump administration fit impact abortion rights.
She say di former president fit take di US back into di days bifor Roe v Wade, a landmark case wey bin protect di right to abortion bifor di Supreme Court cancel am two years ago.
“I dey ask una, from di core of my being, to take our lives seriously," Obama tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile, for Trump rally for Novi, Michigan, a group of Arab and Muslim community leaders bin join di former president on stage to endorse am and explain why dem dey back am.
Di largest Arab population for di US dey for Dearborn, Michigan, wey no far from wia Trump bin speak - and one of dose wey bin dey on stage na di mayor of Dearborn.
Gap between Trump and Harris dey narrow down
Di gap between Trump and Harris dey narrow for di polls as pipo continue to vote.
National polling averages show say Democratic nominee and Vice-President Kamala Harris get small lead over Republican nominee Donald Trump - Harris on 48%, Trump on 47%.
Towards di end of August, Harris bin almost dey four percentage points ahead of Trump but in recent days, dis gap don close, as you dey see for di graphic below.
And while national polls fit give us small idea of how popular a candidate dey across di US, e dey important to consider di state polls for seven key battlegrounds states wey dis helpful guide by BBC Visual Journalism and Data teams unpick.

Di polls dey close, and e no dey clear which candidate go win.
But anoda question dey wey dey hang over dis election: sake of wetin bin happun last time, Trump go accept di election result if im lose?
Political gap fit be a major factor
Donald Trump dey enjoy a huge lead among men, while women tell pollsters say dem prefer Kamala Harris by a similarly large margin.
Di political gender gap reflect ten years of social change and e fit help decide di US election.
For di first woman of colour to secure presidential nomination, and only di second woman to ever come dis close, Kamala Harris dey go to great lengths not to tok about her identity.
“Listen, I dey contest becos I believe say I be di best pesin to do dis job at dis moment for all Americans, regardless of race and gender,” di vice-president bin tok for one CNN interview last month.
A simple guide to di US election
Make we chook eye for some of di basic facts of di US election.
Wen be di election: Di election go happun on Tuesday 5 November, 2024.
Who fit vote: American citizens wey dey 18 years and above. All voters gatz register, except for North Dakota and US citizens wey dey live abroad fit apply for postal vote.
Who be di candidates: Vice-President Kamala Harris dey contest for di Democrats, afta President Joe Biden bin drop out and no oda Democrats stand against her.
Former US President Donald Trump dey represent di Republicans as im dey try make pipo vote for am to become President for di second time.
How dem go determine di winner: For each US state - dem dey 50 in total - dem get a number of electoral college votes wey dey roughly based on dia population.
Wit 538 electoral votes wey dey available, Harris or Trump gatz win at least 270 to become di next president.
Wetin dem dey vote for?: Dem dey vote for who go be US President, dem dey also vote for di pipo wey go be Members of Congress wey dey play important part in passing laws.
When dem go declare winner?: Most times na on di night of di election, but for 2020 e bin take a few days to count all di votes.
Dem go officially swear in di President-elect for January 2025 for Washington D.C.











