Kamala Harris and Donald Trump policies side by side

American voters go face clear choice for president on election day, between Democratic Vice-President Kamala Harris and Republican Donald Trump.
Dis na wetn dem stand for and how dia policies compare on different issues.

Inflation
Harris don tok say her day-one priority go be to try reduce food and housing costs for working families.
She promise to ban anyhow price hike on groceries, help first-time home buyers and provide incentives to increase housing supply.
Inflation rise under Biden presidency, as e also rise for many western kontris, partly sake of post-Covid supply issues and di Ukraine war. E don fall since.
Trump don promise to “end inflation and make America affordable again” and wen dem ask am, im say more drilling for oil go reduce energy costs.
Im promise to deliver lower interest rates, something wey di president no fit control, and im say im go deport undocumented immigrants to reduce pressure on housing. Economists warn say im say im go impose higher tax on imports and dis fit push up prices.

Taxes
Harris wan increase taxes on big businesses and Americans wey dey make $400,000 (£305,000) a year.
But she don also unveil some measures wey go reduce di tax burden on families, including di expansion of child tax credits.
She don break up wit Biden over capital gains tax, supporting more moderate rise from 23.6% to 28% compare to im 44.6%.
Trump propose some tax cuts wey worth trillions, including extension of im 2017 cuts wey mostly help di rich.
Im say im go pay for dem through higher growth and tariffs on imports.
Analysts say di two tax plans go increase di kontri debts, but Trump own more.

Abortion
Harris make abortion rights central to her campaign, and she continue to advocate for law wey support di reproductive rights all over di kontri.
Trump don struggle to find one consistent message on abortion.
Di three judges wey im bin appoint to di Supreme Court while im be president dey important in turning over di constitutional right to abortion, one 1973 ruling wey dem sabi as Roe v Wade.

Immigration
Harris bin get assignment of tackling di root causes of di kontri southern border crisis and help raise billions of dollars of private money to make regional investments wey go help stop di flow north.
Plenty plenty pipo bin cross from Mexico for end of 2023 but di number don drop since to a four-year low.
For dis campaign, she don make her position tougher and emphasis her experience as goment lawyer for California as she take on human traffickers.
Trump don swear to close di border by completing di wall wey im bin dey construct and increasing enforcement.
But im beg Republicans to drop di hardline, cross-party immigration bill, wey Harris dey support.
She say she go revive dat deal if dem elect her.
Im also promise di biggest mass deportation of undocumented migrants for US history.
Experts tell BBC dis one go face legal challenges.

Foreign policy
Harris don swear to support Ukraine “for as long as e take”.
She don pledge say if dem elect her, she go make sure say US and not China go win "di competition for di 21st Century".
She be longtime advocate of two-state solution between Israel and Palestine, and don also call for end to di war for Gaza.
Trump get isolationist foreign policy and want make US comot imsef from conflicts for oda parts of di world.
Im say im go end di war for Ukraine in 24 hours through negotiated settlement wit Russia, move wey Democrats say go give Vladimir Putin more mind.
Trump don position imsef as strong supporter of Israel but no too tok on how im wan end di war for Gaza.

Trade
Harris don criticise Trump sweeping plan to impose tariffs on imports, wey she call national tax on working families wey go cost each household $4,000 a year.
She dey expected to get a more targeted approach to taxing imports, maintain di tariffs wey Biden-Harris administration introduce on some Chinese imports like electric vehicles.
Trump don maketariffs her central pledge for dis campaign.
Im don propose new 10-20% tariffs on most foreign goods, and much higher ones on di ones wey come from China.
Im also promise to entice companies to stay for US to manufacture goods, by giving dem lower rate of corporate tax.

Climate
Harris, as vice-president, help pass di Inflation Reduction Act, wey don push hundreds of billions of dollars to renewable energy, and electric car tax credit and rebate programmes.
But she don drop her opposition to fracking, one technique for recovering gas and oil wey environmentalists dey oppose.
Trump, wen im bin dey White House, roll back hundreds of environmental protections, including limits on carbon dioxide emissions from power plants and cars.
For dis campaign, im vow to expand Arctic drilling and attack electric cars.

Healthcare
Harris na part of White House administration wey don reduce prescription drug costs and cap di price of insulin at $35.
Trump, wey bin don dey promise to dismantle Affordable Care Act, don tok say if dem elect am, im go improve am, without saying anything specific.
Di Act don help millions of pipo to get health insurance.
Im don call for di taxpayer-funded fertility treatment, but Republicans in Congress fit oppose am.

Law and order
Harris try to draw line between her experience as goment lawyer wit di fact say court don convict Trump of crime.
Trump don vow to demolish drugs cartels, crush gang violence and rebuild Democratic-run cities wey im say crimes don overtake.
Im don tok say im go use di military or National Guard, reserve force, to tackle opponents wey im call "di enemy within" and "radical left lunatics" if dem tamper wit di election.

Guns
Harris don make preventing gun violence one of her key pledge, and she and Tim Walz - both gun owners - dey mostly advocate for tighter laws.
But dem go discover say moves like expanding background checks or banning assault weapons go need di help of Congress.
Trump don position imsefas staunch defender of Second Amendment, di constitutional right to carry gun.
Addressing National Rifle Association for May, im say im be dia best friend.

Marijuana
Harris don call for di decriminalisation of marijuana for recreational use.
She say too many pipo don land for prison for possession and e point to unreasonable arrest numbers for black and Latino men.
Trump don match small break on im approach and say time don reach to end "needless arrests and incarcerations" of adults for small amounts of marijuana for personal use.










