Ghana minister Shirley Botchwey emerge secretary-general of di Commonwealth

Shirley Ayorkor Botchwey

Wia dis foto come from, Ghana Presidency

Read am in 3 mins

Shirley Ayorkor Botchwey don emerge as secretary-general of di Commonwealth of nations.

Di 56-nation club wey Britain King Charles elect dey lead, elect di Ghanian diplomat on di final day of dia summit for Samoa. King Charles and Queen Camilla also attend.

Representatives of kontris wey get dia roots from di British colony dey attend di Commonwealth Heads of Goment Meeting wey start for di Pacific Island nation on Monday, wit slavery and di threat of climate change as di major topic.

"Today at #CHOGM2024, Commonwealth Heads of Government don select Hon Shirley Ayorkor Botchwey, currently di Minister for Foreign Affairs and Regional Integration of Ghana, as di incoming Secretary-General of di Commonwealth," di Commonwealth tok on X.

Botchwey, wey be supporter of reparations for transatlantic slavery and colonialism, take over from Britain Patricia Scotland, wey don hold di position since 2016.

For her social media post on X she tok say she dey humbled as dem elected her to serve for di position as pipo begin congratulate her.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

As congratulatory messages dey pour in, Nigeria President Bola Tinubu say im beliv say di experience wey Botchwey get from her extensive career in public administration, foreign affairs and regional development makes her fit for di job perfectly.

Oga Tinubu for statement wia e congratulate Botchwey beliv say "Botchwey leadership experience go bring renewed energy to di Commonwealth efforts to advance meaningful economic and political partnerships wey go drive development and amplify di bloc voice for global affairs."

Presido Tinubu join odas to congratulate Shirley Ayorkor Botchwey, on her election as di incoming Secretary-General of di Commonwealth asim add say she get di backing of Nigeria.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Profile of Shirley Botchwey

Di Commonwealth Parliamentary Association describe her as lawyer, diplomat and politician wey don dey work as di Foreign Minister for Ghana since 2017.

Bifor dat she work as Deputy Foreign Minster, Deputy Minister for Trade and Industry and den member of di Ghana Parliament wey she hold for four terms.

She claim to don lead di move for di unanimous passage of one resolution wey go make sure say UN fund Africa-led peace support operations for November 2023 wen Ghana bin dey inside di UN Security council.

She also claim say she collabo wit oda Ministers for Ghana to run 'Year of Return' and 'Beyond di Return' policies.

She is expected to assume office on April 1, 2025.

Botchwey na di second African wey dem go elect as secretary-general of di Commonwealth since dia 75-year history.

Dis dey come afta Emeka Anyaoku of Nigeria, wey bin serve for dat position from July 1, 1990, to March 31, 2000.