'I no need any supremacy battle wit any king for Yorubaland or di world, nobody fit tok say who Alaafin be' - Alaafin of Oyo

Di traditional tussle of who be di first and highest king for Yorubaland still dey go on as di Alaafin of Oyo don tok say na im be di superior monarch.
Alaafin of Oyo, Oba Abimbola Owoade, tok say e no get any supremacy battle wit any king for Yorubaland or anywia for di world.
Dis dey come afta di Alaafin of Oyo bin give di Ooni of Ife, Oba Enitan Adeyeye Ogunwusi, 48-hour ultimatum make e revoke di Okanlomo of Yorubaland chieftaincy title wey e recently confer on one Ibadan business tycoon, Engineer Dotun Sanusi.
Meanwhile, di Ooni of Ife through im media pesin say e no go reply di ultimatum wey di Oyo monarch bin issue.
Di Oyo monarch through im tok-tok pesin Bode Durojaiye say di position of di Alaafin of Oyo dey well known and e no dey bend tradition.
"Di history don dey so kind and friendly to Alaafin Owoade publicity since e ascended di throne of im forefathers, as e no need to get into any battle for supremacy wit any oba, either for Yorubaland or anywia for di universe," di statement tok.
Di Oyo monarch say im be custodian of Yoruba culture and im dey protect di tradition witout selling di pipo.
According to di Oyo palace for di statement, di monarch don make covenant wit di Yoruba ancestors and im go defend am, and evri name wey e dey bear get deeper root to be representatives of di deity.
"Oba Owoade combine humility wit royalty to meet di modern day demands. Di Alaafin dey inducted into di mysteries of various gods like Ifa, Sango etc to be di direct representative of dis deities for earth."
As di tok-tok for who be di superior king for Yorubaland dey go on among indigenes, several oda pipo don also tok say make di Ooni and Alaafin end dia rivalry.
Meanwhile, di Oyo monarch say im kingdom dey well recognised and dey most important within di early Yoruba race.
In fact, di statement tok say di British recognise di supremacy of Oyo and di Alaafin as di head of Yoruba nation.
"Oyo simply rise to prominence through wealth wey dem gain from trade and dia military skills and na di largest West Africa empire, di most important and authoritative of all di early Yoruba principalities.
"Di British according to dia tradition recognise lineage as meaningful supremacy and legitimacy, wia dem prefer to sign di Treaty of Cessation wit di Alaafin as di superior head of di Yoruba nation," di statement tok.
Also, during di World Sango festival wey hold for Oyo state, Oba Owoade tok say nobody fit question di Alaafin.
Sango na deity (god of fire) wey dey common among di Yoruba race for Nigeria and oda kontris for di world.
Wen di Oyo monarch tok, e narrate di history of how e get im power from im forefathers.
E say di deity dey veri powerful during im time as nobody fit challenge am.
"Sango na Alaafin, Alaafin na Sango. Nobody fit tok say who be Alaafin. Alaafin Sango among all di Alaafin na di third. Nobody fit ask am anytin, or question who e be."
Di monarch say di Sango deity na di first wey international organisation recognise for different parts of di world.
"Sango na di first deity wey Unesco approve for Nigeria and worldwide, Sango no be for only Nigeria, E dey Italy, Brazil and odas."
As e dey tok dis one for di event, pipo dey hail and call im name as mark of honour.
Meanwhile, di Ooni of Ife neva tok or respond to wetin di Alaafin of Oyo tok say na im be di superior head for Yorubaland.
Wetin happun between dem bifor
Di Alaafin of Oyo, Oba Owoade, bin give di Ooni of Ife, Oba Ogunwusi, ultimatum to revoke one chieftaincy title wey e give one business man. E say na only im office get di power to give dat kain chieftaincy title.
For one statement from di director of Media and Publicity for di Alaafin of Oyo, Bode Durojaiye, di monarch describe di Ooni action as one wey fit cause kasala.
E also claim say na direct challenge to im authority, say di Ooni give dat kain title.
Di Alaafin emphasise say na im hold di exclusive right to bestow titles wey cover di entire Yorubaland.
"Di conferment of a Yoruba-wide chieftaincy title by di Ooni not only dey beyond im power but na insult to di Titan of Yorubaland.
"Di Supreme Court imsef don rule say na only di Alaafin get such authority. Yet, di Ooni continue to dey act above di law, trampling on both tradition and di courts."
Di Alaafin warn say if di Ooni fail to withdraw di title within 48 hours, "consequences go follow."
Di kwanta wey lead to court case between di former late monarchs of both Oyo and Ife bin happun for 1991 wen di late Alaafin, Oba Lamidi Adeyemi, write to di military govnor of Oyo State, Colonel Abdulkareem Adisa.
For di letter, di late Oba accuse di late Ooni, Oba Okunade Sijuade, say e do bad wen e bin confer imaginary chieftaincy title of Akinrogun of Yorubaland on di National Chairman of di National Republican Convention, Chief Tom Ikimi.
Up until now, di rivalry of who really be di superior head of Yorubaland between Ooni of Ife and Alaafin of Oyo, still dey cause different kasala.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post










