I don leave pastor work to become shepherd - Soun of Ogbomosho

Di new Soun of Ogbomosho land, Oba Ghandi Olaoye Orumagegê III, say im don stop im work as pastor.
Oba Olaoye during im coronation wey hold on Tuesday 19 December for Ogbomosho, one town for Oyo state, southwest Nigeria tok say im no do pastoral work again but now don become shepherd to all di pipo of Ogbomosho.
Before im enthronement, di new king bin serve as senior pastor for di US branch of one of di biggest Pentecostal Churches for Nigeria, di Redeemed Christian Church of God (RCCG).
As e dey collect staff of office from di Oyo state govnor, Seyi Makinde, Oba Olaoye tok say im kingship no be for Christians alone but for Muslims, traditionalist and for everybody.
“No mata how pesin struggle reach, na only God fit enthrone pesin as king.”
E tell pipo wey dem togeda dey drag di title say make dem join am wit am, uplift di town to greater heights.
Oba Olaoye assure di pipo say im go bring im experience as pastor and entrepreneur wey im be for America for many years come di town.

Controversy bin trail im kingship as di mata even still dey for court. Afta di Oyo state goment announce Pastor Ghandi Olaoye as di new Soun of Ogbomoso on 8 September, some contenders to di throne bin rise against am.
End of Di one wey oda users dey read well well
One of di contestants for di stool Kabiru Laoye bin file suit to argue say Olaoye appointment as Soun dey illegal and e carry di mata go court.
On 25 October, Oyo State High court wey siddon for Ogbomoso upturn di appointment of di new Soun of Ogbomoso, Oba Ghandi Olaoye, sake of illegal selection process.
For im judgment, Justice Kareem Adedokun tok say di appointment of Oba Laoye dey illegal.
Di court den order make Oyo state goment conduct fresh selection process to select new king for di South-west town.
As dem no happy wit di judgement Oba Ghandi and di state government bin file appeal plus application for a stay of execution.
However, before dis coronation ceremony, one Oyo State High Court wey sit for Ogbomosho on 27 November bin grant di stay of execution.
Di judge bin grant di application for stay and direct “all di parties to maintain di status quo ante pending di hearing and determination of di appeal wey di defence of Oba Olaoye plus di state government don already file.

Plenty ogbonge Nigerians, among dem wey include former Vice President of Nigeria, Professor Yemi Osinbajo, Osun State Governor, Ademola Adeleke, Kwara State Deputy Governor, Kayode Alabi, former minister of Information and Culture, Lai Mohammed bin show for di coronation.
Traditional rulers no dey left behind as dem also grace di occasion, among dem na di Oonirisha Ile Ife, King Onitan Ogunwusi, Ojaja II, of Warri, Ogiame Atuwatse III, representatives of the Olubadan of Ibadan, Oba Mohood Olalekan Balogun Alli, Olugb ile Igb, King Francis Alao, Orangun Oke Ila Orangun, Oba Adedokun Abolarin, Owa Ajero tilu Ijero, Olu Iwo land, King Adewale Akanbi, King Joseph Adebayo, Timi Land Edde, King Munirudeen Lawal, Laminisa I and so on.
Who be Ghandi Olaoye di RCCG pastor wey emerge as di Soun of Ogbomoso

Wia dis foto come from, @SOUN/Facebook
Before now, Soun Olaoye na di Pastor of RCCG Jesus House, Washington DC United States of America.
Im dey married to Pastor Mrs Omo Olaoye and dem get two daughters.
Im background show say im study English Language for im first degree and Industrial and Labour Relations as im second degree. Im get oda degrees in oda fields.
Na 1992 e become pastor for RCCG but bifor den im bin dey do business.
Unlike im papa wey try to be King for 1940, Prince Olaoye bin don always maintain say im no get interest for Kingship. But as time dey go on, e say God give am message about di stool.
Sake of say im don spend most of im adult life as pastor, oga Olaoye bin tok say im go retire as clergyman wen e reach 60 years until di traditional position come.
Pastor Ghandi lead RCCG churches for three kontris – Nigeria, Germany and United States. Dis na apart from all oda kontris e don travel go do God work.
“Pastor na shepherd, a traditional ruler, mayor, king or even governor – all of dem be shepherds.
But we as pastors na shepherd for local congregation but king na shepherd of a city. Di major difference na say di pipo wey dem dey lead dey different,” na so Pastor Olaoye tok wen dem ask am about how im go handle im new position as traditional ruler.
More fotos from di coronation



















