Di ultimatum by Alaafin of Oyo na 'empty threat' – wetin dey cause kasala between Ooni of Ife and di Afaafin

Ooni of Ife, Oba Enitan Ogunwusi and Alaafin of Oyo, Oba Abimbola Owoade

Wia dis foto come from, Ooni of Ife/Alaafin of Oyo/Facebook

Read am in 3 mins

Sometin dey happun between two ogbonge Yoruba monarchs for Southwest Nigeria.

Dis na as tori come out say di Alaafin of Oyo give Ooni of Ife 48-hour ultimatum sake of one chieftaincy title matter wey don become controversial.

Na dis one make di Alaafin para, den issue di ultimatum.

But Moses Olafare, tok-tok pesin for Ooni of Ife, Oba Enitan Ogunwusi say dem no go ansa di Oyo King.

Olafare, for Facebook post on Tuesday, say Oba Ogunwusi don particularly tell am to ignore di revered Oyo monarch.

According to am, di Ooni no go respond to wetin e describe as "undignifyable" wit an official response.

"My Principal don direct me against issuing a Press Release on di empty threat of di Alawada Babasala. I beg to disappoint you, gentlemen of di press.

"We no fit dignify di 'undignifiable' wit an official response. We go leave di matter to dey for di public court of opinion, as e already dey treated", e write.

Wetin happun between dem

Di Alaafin of Oyo, Oba Abimbola Akeem Owoade, give di Ooni of Ife, Oba Enitan Adeyeye Ogunwusi, a 48-hour ultimatum to revoke di Okanlomo of Yorubaland chieftaincy title wey e recently confer on Ibadan business tycoon, Engineer Dotun Sanusi.

For one statement on Monday signed by im Director of Media and Publicity, Bode Durojaiye, di Alaafin describe di Ooni action as an "affront."

E also claim say na direct challenge to im authority.

Di Alaafin emphasise say na im hold di exclusive right to bestow titles wey cover di entire Yorubaland.

"Di conferment of a Yoruba-wide chieftaincy title by di Ooni not only dey beyond im power but na insult to di Titan of Yorubaland.

"Di Supreme Court imsef don rule say only di Alaafin get such authority. Yet, di Ooni kontinu to dey act above di law, trampling on both tradition and di courts."

Di Alaafin warn say if di Ooni fail to withdraw di title within 48 hours, "consequences go follow."

Dis kwanta bin happun for 1991 wen di late Alaafin, Oba Lamidi Adeyemi, write to di military governor of Oyo State, Colonel Abdulkareem Adisa.

For di letter di late Oba accuse di late Ooni, Oba Okunade Sijuade, say e do bad wen e bin confer an imaginary chieftaincy title of Akinrogun of Yorubaland on di National Chairman of di National Republican Convention, Chief Tom Ikimi.

Oba Adeyemi describe Oba Sijuade action as outright violation of di sacred institution.