Prince Abimbola Akeem Owoade emerge as new Alaafin of Oyo

Wia dis foto come from, Prince Abimbola Akeem Owoade/Facebook
Oyo State govnor Seyi Makinde don approve di selection of Prince Abimbola Akeem Owoade as new Alaafin of Oyo.
Na di Commissioner for Information and Orientation, Prince Dotun Oyelade confam di appointment for statement e release on Friday.
Di commissioner say govnor Makinde confam Prince Owoade as di Alaafin of Oyo afta full consultations and divinations, wey di Oyomesi recommend.
"Prince Abimbola Akeem Owoade, afta thorough consultations and divinations, dey recommended by di Oyomesi and approved by Governor Seyi Makinde as di new Alaafin of Oyo," di statement tok.
Plenty gbas gbos bin occur over who get authority to appoint, and who go be di new Alaafin of Oyo afta di former one Oba Lamidi Adeyemi III, die for 22 April 2022, at di age of 83.
Di mata bin land for court.
Earlier, some members of di Oyomesi or kingmakers bin raise concern say govnor Makinde dey chook hand for di selection process. Move wey dem bin consider illegal.
Di Oyomesi bin select Prince Lukman Adelodun Gbadegesin as di Alaafin-elect. But di govnor bin get im own candidate.
In response to di di selection of Prince Lukman, di govnor bin want make di kingmakers begin anoda selection process.
For letter wey im bin send to di kingmakers on Thursday to express im plan, Makinde, through di Oyo State Commissioner for Local Goment and Chieftaincy Affairs, Ademola Ojo, appoint im own kingmakers wey im want to join di original ones.
Di govnnor action occur even as di case bin still dey court.
Di appointment of Prince Abimbola Akeem Owoade, according to di Commissioner for chieftaincy affairs, don end all di legal and social gbas gbos wey bin occur to get di new Alaafin.
"Dis decision don rest all di socio-legal controversies wey bin rise since di death of di late Oba Adeyemi," Ojo say.
Prince Abimbola go replace late Afaafin Lamidi Olayiwola Atanda Adeyemi as di next Oyo king.









