President John Mahama ministerial nominees - who dey di list?

collage of four newly appointed ministers

Wia dis foto come from, ABLA GOMASHIE/HARUNA IDDRISU/NAA MOMO-LARTEY/GOVERNS AGBODZA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, President Mahama don appoint nine more ministers of state to form im goment
Read am in 8 mins

President John Mahama of Ghana don appoint more pipo for different ministries to form im goment.

Dis na afta im drop di list of di first batch of nominees as ministers of state afta im inauguration on 7 January.

Di latest list bin contain nine nominees as ministers of state wia di president don submit to parliament for vetting.

Earlier di president appoint three key ministers for Energy, Finance and attorney general.

Dis na Mahama second time to be president of Ghana afta e bin serve as Ghana president bifor from 2012 to 2017.

Ministerial list

On Thursday 9 January, 2025, President John Mahama submit di first batch of di ministerial nominees list to di Speaker of Parliament.

According to di acting tok-tok pesin to di president, Felix Kwaye Ofosu, di submission dey in accordance wit Article 78 of di 1992 Constitution of Ghana.

Di latest batch of 9 ministerial nominees na:

1. Haruna Iddrisu - Minister for education

Haruna Iddrisu

Wia dis foto come from, PARLIAMENT OF GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Oga Haruna na lawyer and businessman wia get plenti experience for politics

Haruna Iddrisu na politician wey get plenti experience for politics for Ghana.

Im na lawyer, businessman wia don lead di NDC for parliament as minority and leader.

Currently, im na di member of parliament for Tamale south for di northern region of Ghana.

In di past NDC goment, oga Haruna Iddrisu bin serve as employment minister and communications minister.

Im get Bachelors degree for sociology from di university of Ghana, wia im be Barrister-at-law and member of di Ghana bar association since 2002. Im also dey own some football clubs for di kontri.

2. Abla Dzifa Gomashie - Minister for Tourism, culture and creative arts

Abla Gomashie

Wia dis foto come from, ABLA DZIFA GOMASHIE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di former deputy tourism minister for di former NDC goment dey return to di same ministry but dis time na substantive minister

Abla na politician and creative arts sabi pesin wia get plenti experience for im work in advocacy and youth leadership.

Im na two-term MP for Ketu South for di volta region wia im lead advocacy for development projects for dia.

Abla for di former NDC goment serve as deputy tourism minister as im promote cultuire and creative arts as well as theatre wia be im passion as an actress, Im get Barchelors degree in Fine arts (first class) and MPhil in African studies from di University of Ghana.

3. Dr Agnes Naa Momo Lartey - Minister for gender, children and social protection

Dr Agnes Naa Momo Lartey

Wia dis foto come from, AGNES NAA MOMO LARTEY/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di gender and human rights advocate bin dey nominated to head di gender ministry for di John Mahama goment

Dr Agnes Naa Momo Lartey na MP for Krowor constituency for di greater accra region, wia im be seasoned legislator and development expert wit ova 20 years experience for project management in health, governance and odas.

Im get Ph.D for African studies wia im be general secretary of di national association of local authorities of Ghana and executive director of di global initiatives on human rights and development.

She also bin serve on critical committees for di Ghana parliament.

4. Kwame Governs Agbodza - Minister for roads and highways

Kwame Governs Agbodza

Wia dis foto come from, KWAME GOVERNS AGBODZA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di experienced architect don dey head to di roads and highways ministry

Kwame Agbodza na architect and politician wey get plenti experience for architectural design and project management.

Im don manage ogbonge projects for di kontri in education, healthcare and odas across Ghana and di UK.

Since 2013 na im be MP for Adaklu for di volta region, wia im rise to become minority chief whip and now najority chief whip for di 9th parliament.

But wit dis appointment, if im pass di vetting for di appointment committee, im go vacate im position as majority chief whip for parliament.

Bifor dis parliament, Kwame Agbodza na ranking member for di roads and transport committee.

5. Elizabeth Ofosu-Adjare - Minister for Trade, agribusiness and industry

Elizabeth Ofosu Adjare

Wia dis foto come from, ELIZABETH OFOSU-ADJARE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Madam Ofosu-Djare go dey under pressure to push di goment policies and 24-hour hour economy

Elizabeth Ofosu-Adjare na lawyer and international relations sabi pesin as well as business expert for di kontri.

Ova di last few decades im dey do advocacy.

She don serve on boards of companies wia im serve as minister for tourism wia im lead some ogbonge initiatives.

Currently im be MP for Techiman north constituency.

6. George Opare-Addo - Minister for youth development and empowerment

George Opare Addo

Wia dis foto come from, GEORGE OPARE ADDO/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, George Opare-Addo esq bifor im nomination as minister na organizer for di NDC

Oga George na local goment sabi pesin, business executive and party organizer.

Im rise to become national youth organizer of di NDC in 2018 wia im get dat position till now.

Im mentor plenti young pipo.

George Opare-Addo esq na former municipaal chief executive for Akuapem North Municipal assembly between 2009 - 2017.

7. Eric Opoku - Minister for agriculture

eric opoku

Wia dis foto come from, ERIC OPOKU/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Eric Opoku na di pesin president Mahama wan make im lead di agric sector for im term of office

Oga Eric Opoku na ogbonge politician wey sabi law, agriculture and leadership.

Im get ova 12 years experience as MP for parliament, wia im rise thru to become ranking member on di food and agric committee and di cocoa affairs comittee.

Oga Eric get barchelors degree for economics and law for (Kwame Nkrumah University of science and technology (KNUST), wia im also get LLM for international business law from di university of Essex, UK.

Im dey come at a time di agric sector especially farmers bin dey complain about lack of inputs, fertilizers and odas.

8. Ahmed Ibrahim - minister for local govment, chieftaincy and religious affairs

Ahmed Ibrahim

Wia dis foto come from, PARLIAMENT OF GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di president don merge di local goment and chieftaincy ministries into one, wia oga Ahmed Ibrahim na di minister wia dem nominate

Ahmed Ibrahim na politician and public servant.

Im dey hold MBA for finance from GIMPA wit BA for political science and philosophy from di university of Ghana. Since 2009, im don serve as MP for Tain wia im later represent di Banda constituency.

Na im be deputy minority and majority chief whip for parliament bifor dem appoint am for di local goment and chieftaincy ministry.

9. Emilia Arthur - Minister for fisheries and aquaculture

Emilia arthur

Wia dis foto come from, EMELIA ARTHUR/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Emilia Arthur na development specialist wia di president dey hope say im go lead di fisheries ministry

Di development sabi pesin wey get expertise for local goment, natural resource management and gender inclusion.

Na she be former presidential staffer under di past NDC goment, deputy regional minister wey im also serve as district chief executive.

She bin work wit ogbonge international organizations like USAID.

Emelia get academic certificates from Yale university and GIMPA.

10. Dr Cassiel Ato Baah Forson - Minister for Finance

Dr. Cassiel Ato Baah Forson, John Abdulai Jinapor and Dominic Akuritinga Ayine

Wia dis foto come from, Dr. Cassiel Ato Baah Forson, John Abdulai Jinapor, Dominic Akuritinga Ayine

Cassiel Ato Forson

Wia dis foto come from, Facebook/Cassiel Ato Forson

President Mahama nominate five-term lawmaker and finance expert, Dr Cassiel Ato Baah Forson as Minister for Finance.

Dr Forson be ogbonge parliament member wey represent Ajumako Enyan Essiam constituency under di National Democratic Congress (NDC).

Profile of Dr Cassiel Ato Baah Forson

Forson na economist, chartered accountant, and tax practitioner wit extensive experience for public finance, macroeconomics, fiscal policy, tax policy, and business management.

According to di president tok-tok pesin, Dr Forson get a PhD for Finance from di Kwame Nkrumah University of Science and Technology and Master of Science degrees for Taxation and Economics from di University of Oxford and di Kwame Nkrumah University of Science and Technology.

E get im Bachelor of Science for Accounting from London South Bank University.

Dr Forson dey well-known for di Ghana parliament and e go now serve as Minister for Finance once di parliament Speaker approve im nomination.

11. John Abdulai Jinapor - Minister for Energy

John Abdulai Jinapor

Wia dis foto come from, Facebook/John Abdulai Jinapor

John Abdulai Jinapor also dey among di ministerial nominees and e go serve as Minister of Energy.

Di president say Jinapor go bring im wealth of hands-on experience, competence, and know-how to di energy portfolio.

"Wit im extensive qualifications, particularly for energy economics and finance, e dey expected to bring much-needed dynamism and capabilities wey go transform di energy sector," Ofosu tok for di statement.

Profile of Hon. John Abdulai Jinapor

Jinapor get a Master of Arts Degree (MA) for Economic Policy Management, MBA for Marketing and a Master of Science (MSc) for Development Finance from di University of Ghana.

E also get a Master of Science (MSc) Degree for Energy Economics from GIMPA and a Postgraduate Diploma for Finance and Financial Law from di University of London.

Hon Jinapor bin serve as high ranking member for di mines and energy committee representing Yapei-Kusawgu constituency for Ghana.

Once dem confam am, e go become Ghana Minister of Energy.

12. Dominic Akuritinga Ayine - Attorney-General and Minister for Justice

Dominic Ayine

Wia dis foto come from, Facebook/Dominic Ayine

Dr Dominic Akuritinga Ayine wey be senior lawyer na di nominee for di position of Ghana Attorney-General and Minister for Justice.

Na member of NDC and e practice law well well for di kontri.

Profile of Dr Dominic Akuritinga Ayine

Dr Ayine na senior lawyer wey get three decades of experience for law practice.

Bifor, e serve as Deputy Attorney General and Minister for Justice and na di founding partner of Ayine & Partners Law Offices.

Dr Ayine get a Ph.D. for law from Stanford University, a Master of Laws (LLM) from di University of Michigan Law School.

Im Bachelor of Laws degree na from di University of Ghana, and e don also lecture for di University of Ghana Law School for many years.

Once dem confam Dr Ayine, e go be Ghana Attorney-General and Minister for Justice.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post