John Mahama set up five-member team for Operation Recover All Loot to get Ghana stolen money

Ghana incoming President John Mahama

Wia dis foto come from, John Dramani Mahama

Read am in 2 mins

President-elect John Dramani Mahama don announce a five-member team to lead im Operation Recover All Loot (Oral) initiative.

Di programme bin feature for Mahama 120-day social contract agenda, seek to combat corruption, reclaim looted state resources, and enforce strict accountability measures for Ghana public sector.

One statement from di Office of President-elect, tok say Mahama appoint five pipo to lead di initiative.

Wetin be Oral?

Oral dey designed as comprehensive strategy to address systemic corruption and financial mago-mago.

By focusing on recovering misappropriated funds and resources, di initiative aim to strengthen governance, restore public trust in state institutions, and provide fiscal space for national development.

Di concept of Operation Recover All Loot bin first gain public attention on September 4, 2024, wen groups affiliated wit di NDC organise one demonstration at di Ministry of Finance to protest wetin dem describe as "gross financial mismanagement" under di outgoing Nana Addo Dankwa Akufo-Addo administration.

Civil society groups, students and private citizens bin attend di protest.

"As preparatory measure toward di rollout of H.E. John Mahama promise to recova proceeds of corruption and hold pesins wey dey responsible for such corruption accountable wen e assume office, a team don dey set up to receive and gada information from members of di public and oda sources, on suspected acts of corruption," di statement tok.

Who dey di team?

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Di members of di team include:

1. Hon Samuel Okudzeto Ablakwa – Chairman

2. Mr Daniel Domelovo-Former Auditor-General

3. COP(Rtd.) Nathaniel Kofi Boakye

4. Mr Martin Kpebu-Private Legal Practitioner

5. Mr Raymond Archer-Investigative Journalist.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

We dey update dis tori