Wetin dey behind Ghana post-election kasala?

Ghanaian riot police facing off the protestors.

Wia dis foto come from, EPA

    • Author, Thomas Naadi
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Police for Ghana don arrest scores of pipo ova act of lawlessness since elections take place for di West African kontri on 7 December.

John Mahama and im National Democratic Congress (NDC) party win both di presidency and di kontri parliament.

Long considered one of di more stable states for di region since im transition to multi-party democracy for 1992, wetin prompt dis recent kasala?

Wetin happun?

Ghana recently witness celebrations across di kontri afta incumbent Vice-President Mahamudu Bawumia concede defeat to im rival John Mahama, di new president-elect.

However, di festivities dey disturbed by Mahama supporters, allegedly looting properties, attacking some state institutions and engaging in disturbances wey injure some military and police personnel.

Tricycles, bags of rice, truck and fertilisers dey among oda items looted at di Tamale Metropolitan Assembly Warehouse and Ministry of Agriculture warehouses in di north and oda parts of di kontri.

Angry youths also reportedly burn two electoral commission offices sake of delayed results, and disagreements ova parliamentary election outcomes.

Why some supporters cause disruption?

Ghana electoral history don often dey marked by incidents of violence and aggressive takeovers of state institutions, businesses, and properties by supporters of di winning party.

Supporters of di winning party often demand say make di incumbent goment appointees vacate dia offices bifor dem swear in di president-elect.

Di practice dey deeply rooted in Ghana electoral system, wey focus on individual candidates and operate on winner-take-all basis.

Di party wey win di presidency gain control of goment positions, state institutions and di kontri resources, making am high-stakes competition.

Di recent events unfolding for Ghana na testament to dis trend. Supporters don demand jobs, while some activists from di National Democratic Congress (NDC) claim say dem dey try to prevent outgoing goment officials from taking office properties.

How di security agencies respond?

Di police arrest ova hundred opposition supporters while one soldier injure while attempting to restore order.

Di police and di military don warn say dem go use lethal force to protect demsefs if personnel dey attacked.

President-elect, John Mahama don condemn di violence and ask di incumbent president, Nana Akufo Addo, to 'act decisively' to restore peace.

NDC party officials also tok say dem meet di Inspector General of Police and urge am to bring order to di situation.