Mahamudu Bawumia ruling NPP candidate concede defeat to John Mahama

Wia dis foto come from, Bawumina
Di ruling New Patriotic Party (NPP) don concede defeat to di opposition National Democratic Congress (NDC) for di 2024 presidential election.
Di Vice President of Ghana wey also be di candidate of di NPP Mahamudu Bawumia concede defeat for one press briefing on Sunday 8 December, one day afta di general elections for di kontri.
Im announcement come bifor di Electoral Commission official declaration of di presidential result.
Oga Bawumia concede defeat immediately afta one press conference wey di NDC hold to claim early lead for di election.
E say im concede defeat based on di provisional results from dia internal tallies from dia party wey show say presidential candidate of di NDC John Mahama don win di election and di NDC also win di parliamentary election, even though dem dey await final collation from a number of seat, but im believe say dat no go change di overall outcome.
E say im don call di candidate of di NDC John Mahama to congratulate am, Oga Mahama also confam di congratulatory call for one post on X.
"Dis morning, I receive congratulatory call from my brother Mahamadu Bawumia following my emphatic victory for Saturday election. Thank you Ghana," di NDC candidate tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di National Democratic Congress (NDC) for Ghana bin don claim early victory ova di New Patriotic Party (NPP) for di kontri general elections.
According to di NDC, dem say based on provisional results dem gada from dia agents across di 276 constituencies, di NDC don secure 'unprecedented, historic victory.'
"We get provisional results wey show how di pipo of Ghana take vote.
From di results we don see so far from our internal collation, e dey clear say Ghanaians don reject eight years of corruption, eight years of state capture", Sammy Gyamfi, National Communications Officer of di NDC tok for one party press conference on Sunday morning.
Di NDC believe say e dey very clear say di pipo of dis kontri don vote for change.
However, na only m di kontri electoral commission get di mandate to declare di outcome of di Ghana 2024 elections.
'Ghana don tok, Ghana do win'
"Di pipo of Ghana don tok, dem don vote for change at dis time and we respect dat decision wit all humility
"Di pipo of Ghana don tok. Di pipo don vote for change at dis time, and we respect dat decision wit all humility." Oga Bawumia tok for di press briefing.
Oga Bawumia say di reason why im concede ahead of di official announcement na to reduce tension and uphold di kontri reputation as beacon of democracy for Africa.
"E dey important say di world investor community continue to believe in di peaceful and democratic character of Ghana. These na our most important assets. Ghana dey important pass our individual ambition and we gatz put Ghana first," e tok.
E add say although dat no be im party desired outcome but dem put dia best foot forward but di voters don tok dia mind.
Electoral Commission neva declare any result
Di Electoral Commission (EC) tok say as at 8:00am on Sunday morning, di commission neva receive any result for di National Collation centre.
Di electoral body post dis informate for one statement on dia Facebook afta di ruling NPP Presidential candidate Mahamadu Bawumia concede defeat to di NDC flagbearer, John Mahama.
Di EC say feedback from di field na say di results dey go di regional collation centre. Di commission go publish di result once dem get am, di electoral body add.
"Di declaration of final results dey hinged in process wey dey enshrined for di law.
"Na di pink sheet go determine di final results. As such di pink sheet wey dem generate from di 40,650 polling stations we di presiding officers and party agents sign go determine di final results. Nothing go change." EC announce.
President Nana Akufo-Addo dey step down afta e reach di official limit of two terms for office.
Mahama, 65, bin don lead Ghana bifor from 2012 until 2017, wen Akufo-Addo replace am.
Im previous time for office bin dey marred by poor economy, frequent power-cuts and corruption scandals.
However, Ghanaians hope say dis time around tins go dey different.









