Final result of Ghana 2024 presidential election result

Di Ghana Electoral Commission don declare former president John Mahama as di president-elect of Ghana.
Mahama of di National Democratic Congress (NDC) beat oda presidential candidates wey contest for di 7 December, 2024 election.
Chairpesin of Ghana Electoral Commission Jean Mensa make di announcement on Monday for Accra.
Former president Mahama, 65-years-old defeat im closest rival wey also be di outgoing vice President of Ghana, Mahamudu Bawumia of di ruling di New Patriotic Party (NPP).
Madam Mensa for her declaration say John Mahama of NDC poll 6,328,397 wey be 56.55% of di total valid votes while Dr Mahamudu Bawumia of NPP poll 4,657,304 (41.61%).
Oga Bawumia bin concede defeat immediately afta one press conference wey di NDC hold to claim early lead for di election.
E say im concede defeat based on di provisional results from dia internal tallies from dia party wey show say presidential candidate of di NDC John Mahama don win di election and di NDC also win di parliamentary election, even though dem dey await final collation from a number of seat, but im believe say dat no go change di overall outcome.
Move around di map to see di results as di Electoral Commission begin announce am
Process of announcing di result
According to di Electoral Commission, di process of announcing di presidential results na say di collation of di results for di presidential election go start from all di polling stations.
Dem go collect di results sheets from di polling stations come send dem to di constituency collation centre, wia dem go declare di constituency results.
From dia, dem go post am to di regional collation centre, wia all di results from all di constituencies for a particular region dey and dem go also declare di winner for di region.
From di region, dem go post di results to di Electoral Commission head office wia political party representatives dey, observers dey, tori pipo dey too sake of say dem wan chook eye for di process.
Na afta all dis process di Chairman of di Electoral Commission of Ghana go put all dis results togeda to announce di winner.
Di voting wey bin start by 7:00 am on Saturday morning close around 5:00pm Ghana time.
Di electoral commission announce di 2024 results on Monday.
Profile of John Dramani Mahama
Dem born John Dramani Mahama on 29 November 1958 for Damongo, di den capital of di West Gonja District of di Northern Region.
Im papa, Emmanuel Adama Mahama, a prominent rice farmer na Member of Parliament for di West Gonja Constituency and di first Regional Commissioner of di Northern Region under Ghana first leader, President Kwame Nkrumah.
E later gain admission into di Ghana premier university, di University of Ghana, for Legon, wia e receive a Bachelor of Arts degree in history in 1981.
Afta im BA degree, John Mahama move back to Tamale, wia e teach history for Ghana Secondary School.
However, di political and economic situation for Ghana force am to relocate to Nigeria, wia e rejoin im papa wey dey for exile.
For 1996, John Dramani Mahama enta Ghanaian politics. E join di National Democratic Congress (NDC).
Dem elect am as di member Parliament of Ghana to represent di Bole- Bamboi Constituency for a four-year term and dem re-elect am for 2000 and 2004 elections.
From 2001 to 2008, Mahama become di Minority Parliamentary tok tok pesin.
Forward to 2008, dem nominate Mahama as running mate to Professor John Evans Atta Mills wia e become Vice President of Ghana in 2009.
For July 2012, Mahama succeed im boss, President John Evans Atta Mills, wey die on July 24, 2012.
By December 2012, dem elect Mahama as President of Ghana for im first four-year term.
Mahama make political history by becoming di first Ghanaian head of state wey dem born afta Ghana declaration of independence for 6th March, 1957.
Now, Mahama dey elected again as president of Ghana to replace Nana Akufo-Addo.
Previous positions Mahama hold
1997 - Deputy Minister for Communications
1998-2001 - Minister for Communications
2001-2005 - Parliamentary Spokesman
2005-2008 - Parliamentary Spokesman
2008 - Vice President of Ghana
2012- President of Ghana












