All don set as Ghanaians ready to vote new president

Ghanaian voter
    • Author, Komla Adom & Annette Arotiba
    • Role, BBC
    • Reporting from, Accra
  • Read am in 3 mins

Election day for Ghana don come, wia debt crisis and high living costs mean say di economy dey im highest in di mind of many voters.

Di West African nation go surely get new president as Nana Akufo-Addo step down afta e reach di di official limit of two terms in office.

But one familiar face fit replace am, dat na if former President John Mahama succeed in for comeback attempt for di NDC party.

Im main opponent na Vice-President Mahamudu Bawumia, wey fit become di kontri first Muslim leader if e win di election for di governing NPP party.

Pipo don form long queues since Friday night dey wait for daybreak to cast dia vote for di Ghana election to select dia president and members of parliament

Ova 18 million pipo for di West African kontri go vote across 40,000 polling centres.

In many parts of di kontri pipo don sacrifice dia night to form queue so dem go fit vote early.

VP Dr Mahamudu Bawumia dey promise to cut taxes and kontinu im digitalization agenda while ex-president John Mahama say im go introduce 25-hour economy to create jobs for many pipo.

But for di voters, di last eight years don hard well well wia dem no fit to afford basic tins like food, shelter and water.

Odas also bin tok say no be Ghana alone wey don suffer wahala from di Covid 19 and Russia-Ukraine war wey scatter many tins.

Di goment say dem wan become di first party to win a third straight term for office; di opposition party say time don reach for chance.

Oga for di Electoral commission Jean Mensah say di commission dey ready to conduct di elections.

From wen voters registration don begin till now, di opposition NDC don open eye for di electoral commission.

Dem tok say di commission no dey do dia tins fairly.

But oga of di EC Jean Mensah for one press conference bifor di 7 December vote tok say "we dey read to conduct election wey be free and fair

Di commission also bin distribute polling materials to all di centres across di kontri

"Everitin don reach di various regions, wia dem go reach everybody, we no dey tink say di materials go finish," Jean Mensa tok.

Im tok say di commission don "also train ova 210,000 pipo wia dem deploy dem to do various centres.

Di commission dey under pressure to ensure say dem conduct dis vote without any wahala.

Oga Jean Mensa tok im staff and oda pipo wia go dey on duty for election say make dem "follow di law" wia dem for dey fair to everibodi

Di electoral commission also bin dey encourage pipo wia don dey vote for di first time to also go out and vote.

Di peace council wey don make di presidential candidates sign one peace pact say dem go accept di result of di election, say dem dey hope all Ghanaians go vote peacefully without say pesin go dey find trouble

Di national security task force wia di Inspector general of police don be oga, also bin assure citizens say dem go offer security for di process across di 16 regions.

"Make una go vote and go house make di oda stakeholders do dia job, make una no cause any wahala wey go affect di kontris image," di IGP tok

For 2020, 8 pipo don die during di kontri elections, na so many pipo including di opposition parties dey chook mouth dey ask wetin happun to di pipo wia shoot di citizens during di elections.

But di police say dis time dem no go allow soldiers for di voting centres to avoid chaos.

Voting dey begin at 7am GMT wia dem go close all di polling centres wia dem go end at 5pm.

Di electoral commission expect say dem go announce results afta 72 hours of close of poll.

For dis election many pipo wey include sabi pipo say issues like economy, jobs, healthcare, education, corruption and illegal mining (galamsey) be di kind tins voters say dem dey expect to use to cast dia vote.