Ghana 2024 election: Ghanaians vote to elect new leaders

Live coverage of Ghana 2024 election

Summary

  • Polls officially close for Ghana election
  • One pesin die for shooting incident for northern region
  • NDC presidential candidate John Mahama don vote
  • Ruling NPP presidential candidate Mahamudu Bawumia don cast im vote
  • Interior ministry announce closure of land borders
  • Army deploy for election monitoring, to stay away from polling units
  • Ghana EC assure of credible polls

Live Coverage

Victor Ezeama and Helen Oyibo

  1. Fotos, videos show vote sorting update for Ghana

    vote counting

    Fotos and videos of vote counting and sorting as officials begin di process of collating results after Ghanaians vote.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

    Election officials dey submit election materials for City Engineers collation center for Accra
    Wetin we call dis foto, Election officials dey submit election materials for City Engineers collation center for Accra
    Election officials dey submit election materials for City Engineers collation center for Accra
    Wetin we call dis foto, Election officials dey submit election materials for City Engineers collation center for Accra
  2. Ghana election result update

    Voting for di Ghana election don officially end, and wetin pipo dey wait for next na di announcement of results.

    Di Electoral Commission of Ghana na di only body wey fit make official announcements as di results begin enta from different polling units.

    Before now, di Electoral Commission bin don break down di process of announcing di results.

  3. Officials begin sorting of ballots as voting end across Ghana

    Electoral officials dey sort ballot papers

    Voting don end for most polling units for Ghana.

    Di polls officially close by 5:00pm.

    Presiding Officers for di polling stations don begin sort, count and collate di votes. Dem go send di votes go di collation centre afta dem count am finish.

    Party agents and some voters dey ground to monitor dia votes.

    Pipo dey tanda dey torchight votes collating as voting don end
    Wetin we call dis foto, Pipo dey tanda dey torchight votes collating as voting don end
    Pesin dey clear out voting areas as voting don end
    Wetin we call dis foto, Pesin dey clear out voting areas as voting don end
    Pipo dey arrange ballot papers as voting don end
    Wetin we call dis foto, Pipo dey arrange ballot papers as voting don end
    Electoral officials dey pack voting materials
    Wetin we call dis foto, Electoral officials dey pack voting materials
    Pesin dey pack voting materials
    Wetin we call dis foto, Pesin dey pack voting materials
  4. Video show moment civilian face sojas close to a polling unit

    Sojas dey manhandle one man

    One video show how fight burst after one civilian face sojas for Obuasi East.

    Dis na afta argument wey di civilian wey be opposition party communications officer, Abdul Hack get with di sojas wey dey patrol as e tell dem make dem no enta a polling station.

    Di argument later turn to fight between di sojas and di civillian.

    Ghana armed forces bin don tok for statement on Friday say "no military personnel go dey stationed for any polling station" and na only wen di Ghana Police Service call dem na im dem go dey deployed.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Breaking, Voting officially end for Ghana

    Voting don end for many polling centers for di Ashanti region of Ghana As dem dey prepare to count di ballot.

    Di goment party NPP bin complain say pipo no turn out in dia numbers to vote.

    Di electoral commission boss Jean Mensa tok say from dia records, na 50% of pipo wia turn out to vote as of 2:ooPM

  6. More on di shooting incident wey kill one pesin for Nyankpala

    Police say one pesin die and anoda pesin injure for one shooting incident for Nyankpala for di northern region during di election.

    Reports wey we just get now say e happun after opposition supporters and ruling party supporters clash.

    According to police, di incident happun wen one opposition parliamentary candidate attempt to file complain to police for Nyankala. But ruling party supporters allegedly stop am.

    Fight start and gunshots begin sound.

    Di shooting last for more dan 30 minutes.

    Soldiers don dey deployed to di town and tins don calm down.

  7. Police dey find anoda shooting suspect for Ghana

    Ghana Police don announce say dem dey find anoda shooting suspect.

    Police dey find am in connection with a shoot out wey injure pesin for leg for di Awutu Senya East Constituency for Central Region.

    Police tok for statement say di suspect tear race comot from di scene of di crime and e leave im motor for dia.

  8. All don set as Ghanaians ready to vote new president

  9. Police arrest four suspects in connection wit shooting incident wey kill one for northern region

    Ghana Police Service don confam one shooting incident for Nyankpala for di northern region of di kontri during di election.

    Di police for statement say one pesin die and anoda pesin suffer injury. "Di injured victim currently dey receive medical care, while dem don carry di body of di deceased go mortuary for presentation and autopsy."

    Police add say dem don arrest four pesins in connection wit di incident and investigation dey go on.

    Sojas don also dey deployed to restore calm to di area.

    Ghana police confam arrest of four suspects for northern region

    Wia dis foto come from, Ghana police

    Wetin we call dis foto, Foto of statement from Ghana police
  10. NDC presidential candidate John Mahama don vote

    Former President John Mahama

    Ghana Former President and di opposition National Democratic Congress (NDC) candidate John Mahama don cast im vote.

    Im vote for front of im supporters and media pipo dem.

    Di NDC candidate vote for im hometown for Bole.

  11. Ghana Police gbab man wey carry weapon come polling station

    Man wit blurred face

    Wia dis foto come from, Facebook/Ghana Police Service

    Authorities for Ghana don gbab one man wey carry weapon for polling station during di ongoing Ghana election.

    Dem gbab di man for St.Theresa school polling station for di Okaikwei South constituency for Accra.

    According to police for Ghana, di suspect go help dem with more informate and dem go investigate am.

  12. EC dey investigate incident for Bayiri Polling Station wia NPP candidate miss for ballot

    Di cut ballot paper

    Wia dis foto come from, Electoral Commission Ghana

    Di Ghana electoral commission don announce say dem dey investigate wetin dey happun for Bayiri polling station wey dey for Bono East wia tori be say dem cut di head of di Presidential candidate of di New Patriot Party, NPP, comot ballot paper.

    For statement, di commission report say di police don already gbab and arrest di ballot issuer, Joseph Derry on top di mata.

    Pipo don dey hala on top social media make dem pause voting for dia on top say e fit affect di way di 15 pipo wey collect di defaced ballot suppose vote.

    Dis na as di commission warn say dem no go hide any election officer wey do anyhow during di election.

  13. Ghanaians show dia commitment to democratic process - Pres. Nana Akufo-Addo

    Foto of Nana Addo Dankwa Akufo-Addo

    Wia dis foto come from, Nana Addo Dankwa Akufo-Addo/Facebook

    President of Ghana, Nana Akufo-Addo say Ghanaians show dia commitment to di democratic process as dem remain peaceful during di ongoing election.

    Afta im cast im vote for im polling unit for Kyebi, di East Akim constituency of di Eastern Region, Akufo-Addo tok say di process dey simple and smooth.

    E encourage pipo wey neva vote to come out and vote.

    “Today, di reports wey dey come in from across di kontri suggest say di election dey go on well. Ghanaians dey show dia commitment, we all need to dey tankful,” e tok.

    “Una wey neva vote, make una go out to vote, each vote count.” E tok.

  14. Ghana Police Service arrest Electoral Commission official for electoral mal-practice

    Foto of suspect Dery Joseph

    Wia dis foto come from, Ghana Police Service/facebook

    Ghana Police Service don arrest one Electoral Commission (EC) official, for issuing 15 ballot papers wit omitted presidential candidate to voters for Ampesika- Bayere polling station.

    Inside one statement on Saturday, di security service say dem arrest di suspect, Dery Joseph for Kintampo south constituency in di Bono East Region wey dem arrest election offence dey under investigation.

    "Di suspect, Dery Joseph, dey under investigation for issuing about 15 ballot papers to voters wey omit di first presidential candidate at di Ampesika- Bayere polling station," di statement tok.

  15. How voting dey go for Accra

    Di voting process for most part of Accra, Ghana dey smooth and peaceful.

    Polls open at 7:00am and eligible voters turn up to vote for dia various polling units.

    To make di process easy, di electoral commission bin divide some polling units into parts, so dat pipo go easily fit vote and avoid long queues.

    Ova 18 million registered voters dey expected to vote for dis election. BBC Pidgin observe say many young pipo come out to exercise dia franchise, also first-time voters show face.

    One first-time voter, 19-year-old Keziah Gyamerah say voting na her right plus di experience sweet her body. She tok say she go continue to vote as long as di process dey seamless.

    BBC Pidgin for di polling stations dem visit for Accra observe say voters no dey too stay long for queue bifor dem vote, e dey take dem about 20 mins or less to exercise dia civic right.

    Two elections dey hold for Ghana today, di presidential election, wey di contest dey tight between di ruling New Patriotic Party and di National Democratic Congress.

  16. Ghana EC oga assure media of collation coverage

    Foto of Jean Mensa

    Wia dis foto come from, JeanMensa/Facebook

    Di Electoral Commission (EC) for Ghana, say dem go give access to all media organisation to get access to all di polling units and collation centres across di regions

    Jean Mensa, di chairperson of EC tok say dem go begin access to media organisations make dem get access to di polling units and collation centers

    During one press conference she address di issue of transparency in di electoral process and di role of the media during di election.

    "As you know since 1992, we only grant access to media only wen dem wan declare di win, na dat time dem dey invite media but today e don change, going forward media go get access to all our centres across di kontri," she tok.

  17. NDC vice presidential candidate Agyemang call for more voters to come out

    Foto of Opoku Agyemang

    Wia dis foto come from, Opoku Agyemang/X

    Vice presidential candidate of National Democratic Congress, Opoku Agyemang, don addressed di issue of low turnout of voters, afta she cast her vote for her polling unit.

    She encourage Ghanaians make dem come out to participate in dia civil rights.

    "You fit dey vex but na becos of dat you suppose vote, why you dey vex? Dis na good reason to vote," she tok.

    "Na very important day and di outcome go become everyone of us. No be for personal reasons, I wan encourage everybody wiaever dem dey make dem come."

  18. US, UK send message give voters for Ghana

    A man voting in Ghana

    Di US Embassy for Ghana don send message give voters for Ghana say make dem ensure peaceful and transparent elections.

    "We doff cap for evri body wey dey stand for election today and to all of dos volunteers, election observers, and security forces wey dey work to ensure peaceful, credible and transparent elections".

    Also, di UK embassy for Ghana say make voters uphold credible election.

    Canada also chook mouth for di Ghana election wia dem dey preach free and fair election.

    "Di High Commission of Canada wish all Ghanaians an inclusive, free, fair and peaceful election.

    Meanwhile, election don dey enta serious stage as voters don come out fully to cast dia vote.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  19. Ghana Election: 'We dey very hopeful say politicians go maintain peace' former president of Nigeria Jonathan

    Foto of Goodluck Jonathan

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Former President of Nigeria Goodluck Jonathan say im dey hopeful say politicians go maintain peace through out di electioneering process for Ghana.

    Goodluck Jonathan wey lead members of di West Africa Elders Forum, address tori pipo for Ayawaso West Wuogon, during di ongoing president election for Ghana.

    Di former President of Nigreria tok say members of di forum go join oda stakeholders in resolving issues wey fit rise during di election.