John Mahama declared winner of Ghana presidential election

Foto of Ghana president-elect, John Dramani Mahama

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 5 mins

Di Ghana Electoral Commission don declare former president John Mahama as di president-elect of Ghana.

Mahama of di National Democratic Congress (NDC) beat oda presidential candidates wey contest for di 7 December, 2024 election.

Chairpesin of Ghana Electoral Commission Jean Mensa make di announcement on Monday for Accra.

Former president Mahama, 65-years-old defeat im closest rival wey also be di outgoing vice President of Ghana, Mahamudu Bawumia of di ruling di New Patriotic Party (NPP).

Madam Mensa for her declaration say John Mahama of NDC poll 6,328,397 wey be 56.55% of di total valid votes while Dr Mahamudu Bawumia of NPP poll 4,657,304 (41.61%).

"Di results from nine constituencies neva come but di total number of votes from dos constituencies no go still affect di outcome of di result," she tok.

Na ova 18 million pipo for di West African kontri bin go vote across 40,000 polling centres to elect a new president and oda parliamentary members.

E now dey clear say President Nana Akufo Addo presidential term go end for 7 January, 2025 and e go hand-ova to di new president.

Bifor di Electoral Commission official declaration of di presidential result, di ruling New Patriotic Party (NPP) concede defeat to di opposition National Democratic Congress (NDC) for di 2024 presidential election.

Di Vice President of Ghana wey also be di candidate of di NPP, Mahamudu Bawumia concede defeat for di press briefing on Sunday 8 December afta di general elections for di kontri.

Oga Bawumia concede defeat immediately afta di press conference wey di NDC hold to claim early lead for di election.

E say im call di candidate of di NDC John Mahama to congratulate am, Oga Mahama also confam di congratulatory call for one post on X.

"Dis morning, I receive congratulatory call from my brother Mahamadu Bawumia following my emphatic victory for Saturday election. Thank you Ghana," di NDC candidate tok.

Profile of John Dramani Mahama

John Mahama raising his hand

Wia dis foto come from, Facebook/John Mahama

John Dramani Mahama, born on 29 November 1958 for Damongo, di den capital of di West Gonja District of di Northern Region.

Im papa, Emmanuel Adama Mahama, a prominent rice farmer na Member of Parliament for di West Gonja Constituency and di first Regional Commissioner of di Northern Region under Ghana first leader, President Kwame Nkrumah.

E later gain admission into di Ghana premier university, di University of Ghana, for Legon, wia e receive a Bachelor of Arts degree in history in 1981.

Afta im BA degree, John Mahama move back to Tamale, wia e teach history for Ghana Secondary School.

However, di political and economic situation for Ghana force am to relocate to Nigeria, wia e rejoin im papa wey dey for exile.

For 1996, di year mark di year wey John Dramani Mahama enta Ghanaian politics. E join di National Democratic Congress (NDC).

Sake of im tok tok power for di underprivileged, dem elect am as di member Parliament of Ghana to represent di Bole- Bamboi Constituency for a four-year term and dem re-elect am for 2000 and 2004 elections.

From 2001 to 2008, Mahama become di Minority Parliamentary tok tok pesin.

Forward to 2008, dem nominate Mahama as running mate to Professor John Evans Atta Mills wia e become Vice President of Ghana in 2009.

For July 2012, Mahama succeed im boss, President John Evans Atta Mills, wey die on July 24, 2012.

By December 2012, dem elect Mahama as President of Ghana for im first four-year term.

Mahama make political history by becoming di first Ghanaian head of state wey dem born afta Ghana declaration of independence for 6th March, 1957.

Now, Mahama dey elected again as president of Ghana to replace Nana Akufo Addo.

Previous positions Mahama hold

1997 - Deputy Minister for Communications

1998-2001 - Minister for Communications

2001-2005 - Parliamentary Spokesman

2005-2008 - Parliamentary Spokesman

2008 - Vice President of Ghana

2012- President of Ghana

Jane Naana Opoku Agyemang become Ghana first female vice president

Jane Naana Opoku Agyemang

Wia dis foto come from, Facebook/Jane Naana Opoku Agyemang

Ghana make anoda democratic history as NDC running mate, Professor Naana Jane Opoku-Agyemang emerge di first female Vice President-elect for di kontri.

Dem born Opoku-Agyemang on 22 November 1951, for Cape Coast, Central Region.

She get Bachelor of Arts degree for English and a Diploma in Education from di University of Cape Coast (UCC).

One of di ogbonge tin wey first launch her forward na wen she become di first female Vice Chancellor of any Ghanaian public university. Dem appoint her as di VC of University of Cape Coast.

Prof Opoku-Agyemang begin her journey into politics for 2013 wen she get appointment as Ghana Minister for Education under President John Dramani Mahama administration.

Now, she go serve as vice to Mahama to lead di kontri for four years.