Iran nuclear programme - wetin e be and wetin US and Israel want?

Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu, Iran Supreme Leader Ali Khamenei and US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Raffi Berg
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

US and Iran dey plan to hold dia first meeting in years on Saturday to try reach one new deal ova Iran controversial nuclear programme.

Donald Trump bin pull US out of a previous nuclear agreement between Iran and world powers for 2018, and reinstate economic sanctions, wey vex Iran.

Trump don threaten military action if di talks no succeed.

Why Iran no dey allowed to get nuclear weapons?

One worker wear white hard hat dey ride bicycle in front of di reactor building of di Bushehr nuclear power plant, just outside di southern city of Bushehr, Iran, for October 2010.

Wia dis foto come from, AP

Iran say dia nuclear programme na only for civilian purpose.

Dem insist say dem no dey try to develop nuclear weapons, but many kontris - as well as di global nuclear watchdog, di International Atomic Energy Agency (IAEA) - no believe dem.

Suspicions about Iran intentions start for 2002 wen dem find out say di kontri get secret nuclear facilities.

Dis break one agreement wey dem call di Nuclear Non-Proliferation Treaty (NPT), wey Iran and almost all oda kontris bin sign.

Di NPT allow kontris to use non-military nuclear technology - like for medicine, agriculture and energy - but e no permit di development of nuclear weapons.

One colour-coded map show di different types of nuclear facilities for Iran, including research facilities, uranium mines and conversion plants as well as nuclear power plant and a uranium enrichment plant.

How far Iran don advance for dia nuclear programme?

Since US pull out of di existing nuclear deal - wey dey known as di Joint Comprehensive Plan of Action or JCPOA - for 2018, Iran don breach key commitments, in retaliation for di decision to reinstate sanctions.

Dem don install thousands of advanced centrifuges (purification machines) to enrich uranium, somtin wey JCPOA ban .

Nuclear weapons require uranium wey go dey enriched to 90% purity. Under di JCPOA, Iran bin only dey allowed to possess up to 300kg (600lb) of uranium enriched to 3.67% - sufficient for civilian nuclear power and research purposes but no be nuclear bombs.

But by March 2025, IAEA say Iran get about 275kg of uranium wey dem don enrich to 60% purity. Dat dey enough to theoretically make about half a dozen weapons, if Iran further enrich di uranium.

US officials say dem believe say Iran fit turn dat uranium into enough weapons-grade material for one bomb under a week. However, dem also say e go take Iran between a year to 18 months to build a nuclear weapon. Some experts say dem fit build one "crude" device in six months or less.

Why Trump pull out of di previous nuclear deal?

Di UN, US and EU bin impose extensive economic sanctions on Iran from 2010, sake of suspicions say dem dey use dia nuclear programme to develop bomb.

Di sanctions stop Iran from selling oil for international markets and freeze $100bn of di kontri foreign assets. dia economy enta recession and di value of dia currency fall well-well wey cause inflation to soar.

For 2015, Iran and six world powers – US, China, France, Russia, Germany and UK – agree wit JCPOA afta years of negotiations.

As well as limiting wetin Iran dey permitted to do wit dia nuclear programme, e allow di IAEA to access all of Iran nuclear facilities and to carry out inspections of suspect sites.

In return, di powers agree to lift di sanctions.

Dem set up di JCPOA to last up to 15 years, afta den di restrictions go expire.

One Iranian technician wear gloves and oda protective cloth e hold one clipboard for im left hand in front of equipment for di Isfahan Uranium Conversion Facilities (UCF) for Iran on 3 February 2007.

Wia dis foto come from, Getty Images

When Donald Trump enta office for 2018, im remove US – wey be key pillar for di agreement – from di agreement.

Im say na "bad deal" because e no dey permanent and e no address Iran ballistic missile programme, among oda tins. Trump re-impose US sanctions as part of a "maximum pressure" campaign to force Iran to negotiate a new and expanded agreement.

Trump's decision bin dey influenced by America regional allies wey bin dey against di deal, chiefly Israel.

Israel claim say Iran bin still dey pursue a covert nuclear programme, and dem warn say Iran go use billions of dollars in sanctions relief to strengthen dia military activities.

Wetin US and Israel want now?

Trump announcement about meeting wit Iran take Israel by surprise. Im don tok bifor say im deal go "better" pass di JCPOA, although up till now Iran bin don reject renegotiating di agreement.

Trump bin previously warn say If Iran no make a new deal "bombing go happun".

Im national security adviser Mike Waltz say Trump want di "full dismantlement" of Iran nuclear programme, im add say: "Dat na enrichment, dat na weaponisation, and dat na dia strategic missile programme."

Although Trump say dem go get "direct talks", Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi say di negotiations, for Oman, no go dey direct. Im say Iran dey ready to engage wit US, but Trump must first agree say nothing like "military option".

Afta Trump announcement Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say di only acceptable deal go involve Iran agreeing to eliminate dia nuclear programme. Im say dat mean say: "We go in, blow up di facilities, and dismantle all di equipment, under American supervision and execution."

Israel biggest fear na say Trump fit accept a compromise short of Iran complete capitulation wey im fit present as a diplomatic win.

Israel, wey neva sign di NPT, many feel say dem get nuclear weapons, something wey dem neva confam or deny. Dem believe say a nuclear-armed Iran, wey no accept Israel right to exist, fit pose serious threat.

US and Israel fit attack Iran?

Both US and Israel get di military capabilities to bomb Iran nuclear infrastructure, but dat kain operation dey complex and risky, wit uncertain outcome.

Key nuclear sites dey buried deep underground, meaning only di most powerful bunker-busting bombs fit possibly reach dem. While US possess dis bombs, Israel no get am .

Iran go almost certainly defend diaself, dis fit include attacking US assets for di region, and firing missiles to Israel.

For dis kain operation , US go likely need to use dia base dem for Gulf, as well as aircraft carriers.

But kontris like Qatar, wey dey hosts di biggest US airbase, no go agree to help dem attack Iran, sake of fear of retaliation.