Wetin to know about Iran missile attack on Israel

Wetin we call dis Video, Video show missiles fired towards Tel Aviv
    • Author, Matt Murphy
    • Role, BBC News
    • Reporting from, London
  • Read am in 3 mins

Iran don launch hundreds of missiles inside Israel, wit at least some hitting Israeli territory.

Na di second attack by Iran dis year, afta dem fire hundreds of missiles and drones inside Israel in April.

Israeli army officials say di attacks appear to don finish and say no more threat dey come from Iran "for now". But how much damage doz strikes cause neva clear.

Hia na wetin we sabi so far.

How dat Iran attack big reach?

Iran launch around 180 missiles towards Israel, di Israeli military tok. Di attack big small pass wetin happun for April, wey see about 110 ballistic missiles and 30 cruise missiles fired towards Israel.

Video by Israeli TV appear to show how some missiles dey fly ova Tel Aviv area shortly bifor 19:45 local time (17:45 BST).

Military officials don confam say some hits happun during di attack. One military tok-tok pesin say Israel record "a few hits in di centre and oda areas in di south of di kontri".

Meanwhile, di IRGC claim say 90% of missiles hit dia targets. IRGC sources tell state media for Tehran say dem bin target three Israeli military bases in di attack.

But di Israeli military maintain say "a large number" of di missiles wey Iran fire no land. Flashes for sky above Tel Aviv appear to show air defences dey stop some incoming fire.

For Jerusalem, BBC reporters on ground say dem hear at least two interceptions.

Israeli medics say dem neva hear tori of any serious injuries, though di shrapnel wunjure two pipo. Di military tok for anoda message.

Why Iran attack Israel?

Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) for statement say di attacks na response to Israel killing of dia top IRGC commander and leaders of Iran-backed militias in di region.

E tok about di killings of Hezbollah chief Hassan Nasrallah and IRGC commander Abbas Nilforoshan for Beirut last weekend.

Dem also tok about di killing of Hamas political leader Ismail Haniyeh for Tehran in July. While Israel neva gree say dem get hand for Haniyeh death, many pipo believe say na dem do am.

One senior Iranian official tell Reuters say di kontri Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, bin don approve di attack.

Di attack na part of di rising tension of war between di two powers. Iran no recognise Israel right to exist and no want make dem dey at all.

Dem don spend years dey support paramilitary organisations wey no like Israel as part of dia Axis of Resistance.

Israel believe say Iran pose serious threat and don spend many years dey run secret operations against Tehran.

Israel Iron Dome stop Iran missiles?

Israel get one ogbonge system of air defences, di most popular one wey be di Iron Dome. Dem design am stop short-range rockets of di type wey Hamas and Hezbollah pipo dey fire.

While dem dey use am to defend against some elements of Iran last attack in April, oda elements of di kontri "layer" defence systems be like e dey di most work on Tuesday.

David Sling - a joint US-Israeli manufactured system - dey used to stop medium to long-range rockets, and ballistic and cruise missiles. And wen e come long-range ballistic missiles, wey fly outside di earth atmosphere, Israel get di Arrow 2 and Arrow 3 interceptors.

A BBC graphic showing the Israeli defence systems

How Israel allies react?

Di White House say President Joe Biden bin don order US forces in di region to "assist Israel defence" and shoot down Iranian missiles.

One tok-tok pesin for Pentagon say US Navy destroyers fire about twelve interceptors against Iranian missiles wey dey go Israel.

Di BBC also verify video wey show missile interceptions ova di Jordanian capital of Amman. Di kontri also shoot down a number of missiles during Iran last attack in April.

UK Prime Minister Sir Keir Starmer condemn di attack "in di strongest terms" during a call wit im Israeli counterpart Benjamin Netanyahu on Tuesday.

"We stand wit Israel and we recognise her right to self-defence in di face of dis provocation. Iran must stop diz attacks togeda wit dia supporters like Hezbollah."

Wetin go happun next?

Di Israeli military dey already warn of serious effects sake of di attack. Israel Defense Forces (IDF) tok-tok pesin Daniel Haggari say di attack bin dey "serious" and say di kontri dey on high alert.

"Dis attack go get consequences," Rear Adm Haggari tok. "We get plans, and we go operate at di place and time we decide.”

Earlier, US Defense Secretary Lloyd Austin say "serious consequences" go dey for Iran if dem carry out attack on Israel afta e tok wit di kontri defence minister, Yoav Gallant.

In dia statement, di IRGC say Tehran response go dey "more crushing and ruinous" if Israel revenge.

A BBC graphic showing the range of Iran's missiles