iPhones go cost more becos of Trump tariff on China?

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Liv McMahon
- Role, Technology reporter
- Author, Zoe Kleinman
- Role, Technology editor
- Read am in 6 mins
Di world most popular gadgets like phones, laptops, tablets, smartwatches fit dey more expensive for di US.
Many of dem na made in China wey now dey face 125% tariff on dia goods wey dey imported to di US sake of President Donald Trump controversial trade policy.
Di effect dis fit get on di iPhone and im maker Apple dey under di spotlight as some analysts say if costs dey passed to consumers, iPhone prices for di US go rise by hundreds of dollars.
And if di tariffs impact di value of di dollar, e fit dey more expensive to import iPhones and oda devices from oda parts of di world - wey fit cause higher prices for di UK shops.
Ben Wood from CCS Insight tell di BBC say if tariffs stay as dem dey, Apple fit increase di price of iPhones globally wen di next edition come out.
E say, "e no really gel say di company go want make di prices dey different globally" - as di tech giant go wan make pipo no buy am cheaper for UK kon sell am for profit for America.
But oda reason say e go fit cause am to dey cheaper if di companies wey go normally send dia products go US instead send am to kontris wey no get dat kain giant tariffs like di UK.
And ogbonge change fit dey if di cost of tariffs dey passed to customers around di world, wey mean longer contracts to spread di payment of di phones.
End of Di one wey oda users dey read well well
As normal phone contract fit typically last two years, oga Wood say some companies dey already offer four years deals and e believe say, "we fit see five-year contracts" for 2025.
E say, "one fit even tok say na like you get mortgage for your smartphone".
Wia dem dey make iPhones?
Di US na ogbonge market for iPhones and Apple bin get ova half dia smartphones sales for dia last year, according to Counterpoint Research.
E say about 80% of Apple iPhones wey dem dey make to sell for US na made in China and di remaining 20% na made in India.
Togeda wit oda big smartphone companies like Samsung, Apple don dey try to diversify dia supply chains in recent years so dem no go need to over depend on China.
India and Vietnam don comot as di frontrunners for di additional manufacturing.
As tariffs bin start, tori be say Apple dey reason how to increase dia production from India recently.
Reuters report on Thursday say Apple charter cargo flights to ship ova 600 tones of iPhones from India to di US.
Wit di 90 day pause wey Trump put on top tariffs including di one wey dem sama India, di kontri dey set to benefit from iPhone manufacturing boost.
Di BBC don contact Apple make dem chook mouth on di impact of tariffs for dia operations and prices but neva hear anytin yet.
How tariff war wit China fit affect Apple
Apple most recent iPhone go dey hit by di 125% tariff.
Na China dem dey manufacture iPhone 16 Pro Max, so US goment go impose tariff, Apple go pay di tariff to di US goment, den Apple go ship di phone to di US customers.
Apple fit absorb some of di tariff by making less profit or cutting oda costs.
Apple fit pass all di cost to dia customers.
US customers fit accept higher price and continue to buy iPhone Pro Max.
US customers fit go for cheaper iPhone or dem no go too dey buy new models.
Apple fit lose customers to rival phone companies or pre-owned devices.
How exposed Apple dey to tariffs?
Trump and im advisors say dia reason for tariffs na to encourage more US manufacturing.
But di tech industry dey rely on global network of suppliers for dia product components and assembly.
For dis reason and also becos to find skilled workers wey go fit match di fast pace and low cost of production for Asia mean say relocationg supply chains no be small tin.
Apple bin commit $500bn investment for di US for February wey di Trump administration bin believe say go cause more homegrown manufacturing.
But Dan Ives wey be analyst for Wedbush Securities say to shift parts of dia supply chain from cheaper manufacturing areas for Asia to di US go take plenti time and money.
E write for X on 3 April say, "di reality be say e go take 3 years and 30 billion dollars by our calculations to move even 10% of di supply chain from Asia enta US wit ogbonge disruption for di process".
Shey iPhone prices go up?
Apple neva reveal weda dem plan to pass on di costs of di tariffs onto consumers for US and increase prices.
Some analysts believe say Apple dey in beta position dan odas, as dem don make more money from dia products pass wetin dem spend to make dem.
Forrester principal analyst Dipanjan Chatterjee tok say, "As a company wey get beta margins for dia devices, Apple ft swallow some of di tariff cost increases witout say e affect dem financially too much at least for di short term."
But e reason say di company strong brand and popularity fit allow am to pass some of di costs to costumers witout plenti backlash.
Some estimates suggest say iPhone prices fit triple if di costs dey passed to consumers.
According to estimates by investment banking firm UBS, afta Trump tariff increase on China to 125%, di price for China-made iPhone 16 Pro Max wit 256GB storage go don jump from $1,199 to $1,999.
Dem estimate less increase for di iPhone 16 Pro 128GB storage wey dey made in India by five percent from $999 to $1046.
While some analysts like Dan Ives don tok say di price of "Made in USA" iPhone fit rise reach $3500.
Wetin consumers fit do?
Plenti tins no clear about wetin go happun next and na to watch how companies like Apple go ansa di tariffs mata.
But e neva stop some US customers to dey rush enta Apple stores to buy dia smartphones.
Di BBC follow shoppers outside one Apple Store for New York tok as dem bin don buy products sake of fear of potential price hike.
Anthony Cacioppo wey be 53 years old DJ and security technician wey buy new iPhone say, "I no really need phone but I no ready to pay double di price."
Bruce Conroy wey be hairdresser tell di BBC say even if di price fly go up e "go still dey wit Apple products" but go fit delay to buy new iPad.
Julia Baumann wey be personal finance editor tok say she buy her new MacBook becos, "di tariffs dey come, I wan buy am bifor di prices go up and I expect say dem go go up".

We go need to wait till autumn to see how much di next iPhone go cost.
But e be like di price wey tariff dey bring come go cause higher price tags, wey go make pipo dey reason rival phones or to buy second hand sef.
CCS Insights estimate say 5.5m second hand smartphones na im dem go sell for UK for 2025 wey represent 29.7% of di whole market.
Di iPhone na im stay as di most expensive smartphone for market and brands like Google and Samsung get phones wey get features like am but for cheaper price.
Di oda option wey be di most cost effective na for pipo to doge upgrades to new iPhones and instead find slightly older and cheaper versions.
"Di path of least resistance na to keep di smartphone wey dem already get for longer," oga Wood tok.
Additional reporting by Paul Sargeant, Tom Finn and Pratiksha Ghildial.











