Five tins wey don happun for Rivers since President Tinubu declare state of emergency

Ibas, Tinubu and Fubara

Wia dis foto come from, RSGH, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu/Facebook, Sir Siminalayi Fubara/Facebook

    • Author, Tamara Ebiwei
    • Role, Journalist
    • Reporting from, Abuja
  • Read am in 5 mins

On 18 March, 2025, Nigeria President Bola Tinubu make di big announcement for national television wia e e declare state of emergency for Rivers State and suspend Govnor Siminalayi Fubara for di south-south Nigerian state.

Di announcement bin cause mixed feelings, press statements begin fly upandan about di alleged 'undemocratic' decision and step wey President Bola Tinubu take.

During di announcement, oga Tinubu also announce di suspension of Fubara deputy, Professor Ngozi Odu and members of di House of Assembly.

Oga Tinubu tok say di emergency na to bring 'peace' for di state.

Di president den announce Vice Admiral Ibok-Ete Ibas as Rivers Sole Administrator.

But wit di tins wey dey happun for di state, pipo dey wonder if dem dey bring peace for wia war no dey or dem dey cause more kasala.

Sabi pipo dey also tok say some of di tins wey di sole administrator dey do dey against di law.

Dis na five tins wey don happun for Rivers State since di state of emergency declaration:

PDP govnors drag Tinubu go court

Sake of the declaration of state of emergency for Rivers State, eleven PDP Govnors drag President Bola Tinubu go court.

Di govnors of Adamawa, Enugu, Osun, Oyo, Bauchi, Akwa Ibom, Plateau, Delta, Taraba, Zamfara and Bayelsa states do collabo for di case.

Dem file di suit against Tinubu as dem challenge im declaration of state of emergency for di Supreme Court.

Na on Tuesday dem file di suit.

Di govnors wey file di suit thru dia state Attorney Generals put dia summons on eight grounds.

Dem tell di Supreme Court to determine weda di way oga Tinubu declare state of emergency for Rivers State no go against di 1999 constitution as amended.

FG release Rivers State allocation

As di kasala wey suspended Rivers State Govnor Siminialayi Fubara and di 27 members of di Rivers State House of Assembly kontinu to drag, e finally end for Supreme Court.

And Supreme court say make dem cease Rivers State allocation until Govnor Siminialayi re-present di budget to di proper House of Assembly.

Dis na sake of say Supreme Court for dia judgement recognise di 27 lawmakers as di real Assembly members.

As Govnor Sim try to re-present di budget, e no work sake of say di House of Assembly no give am di chance.

For dis reason, Rivers State goment bin no fit pay workers salary and do oda tins.

But as President Tinubu swear in di Sole Administrator, Federal Goment release Rivers State allocation and oga Ibas pay salaries.

Di question wey pipo dey ask be say, which budget di sole administrator dey use work now?

Di mata no end dia, as few weeks ago, Oga Ibas tok say im wan do new budget, di statement receive different condemnations and e neva dey clear if true-true oga Ibas wan do anoda budget.

Appointment of new SSG and Head of Service wey resign

As oga Ibas resume duty for Rivers State Goment House, e dey march leg for ground to show say im dey for at least di "initial six months period", according to di president.

However, since e come out of retirement as a former Naval chief, oga Ibas don take some kain steps to show im presence for Rivers state as di sole administrator.

Di appointment of new SSG na one of di big appoints im do, apart from im Chief of Staff wey bin don start work already, di Rivers State sole administrator appoint Professor Ibiba Lucky Worika as di new Secretary to di State Goment.

Ibas also announce say di Head of Service for di state don resign.

Meanwhile, di sole administrator appoint Dr Inyingi Brown wey be Permanent Secretary Welfare to act for di Office of di Head of Service until dem appoint new Head of Service.

Oga Ibas bin also hold meetings wit security chiefs, e do broadcast for di state and also inspect some of di projects wey Govnor Fubara bin dey do bifor im chop suspension.

Dissolve boards and all political appointees under Fubara

As di sole administrator for Rivers State kontinu wit im administration, e also dissolve all existing boards, parastatals, and commissions for di state.

Im also remove all political appointees wey suspended Govnor Fubara appoint.

Di former Chief of Naval Staff also announce new appointments for di Civil Service and Local Government Service Commissions.

Dis appointments wey im do still dey cause tok-tok for di state sake of say Federal High Court bin give restraining order but e no obey am.

Oga Ibas still do ogbonge appointments into di Rivers State Independent Electoral Commission.

Appoint local goment administrators

Di latest appointments wey di sole administrator do na dat of di local goment administrators.

Ogbonge citizens of di state dey para as dem tok say di sole administration don dey match line.

For one special announcement wey di Secretary to di State Goment (SSG), Professor Ibibia Lucky Worika, sign e tok say:

"His Excellency, Vice Admiral (Rtd) Ebok-Ete Ekwe Ibas CFR, Administrator of Rivers State, don approve di appointment of members of di Civil Service Commission and Local Government Service Commission."

Appointees to di Civil Service Commission include: Dr. Livinus Bariki – Chairman, Amb. Lot Peter Egopija – Member, Mrs. Maeve Ere Bestman – Member, Mrs. Joy Obiaju – Member, Mrs. Charity Lloyd Harry – Member.

Appointees to di Local Government Service Commission na: Mr. Israel N. Amadi – Chairman, Mr. Linus Nwandem – Member, Lady Christabel Ego George Didia – Member, Dr. Tonye Willie D. Pepple – Member, Barr. Richard Ewoh – Member, Rear Admiral Emmanuel Ofik (Rtd) – Member and Dr. Sammy Apiafi – Member.

Professor Worika confam say di appointments go take effect from 7 April 2025.

Meanwhile, in di midst of all dis drama and kasala, di suspended Rivers State Govnor Siminalayi Fubara bin call for calm .

For statement wey e sign imsef, Govnor Fubara bin maintain say since e enta office as govnor, all im actions and decisions dey guided by im constitutional oath of office and a great sense of duty.

E say e bin prioritise di protection of lives and property and ensure continuous progress of di State.