MPs for South Korea vote to impeach president Yoon

South Koreans dey jubilate for Seol

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Members of Parliament for South Korea don vote to impeach President Yoon.

Out of di 300 lawmakers, 204 votes dey in favour of im impeachment while 85 vote against am, three abstentions and eight invalid votes.

Speaker Woo Won-shik announce say dem don pass di impeachment vote, as im conclude di session.

"To di pipo, we hope your end of year go dey a little happier now, and all of una cancelled year-end celebrations go dey restored," im tok.

"Di future of di Republic of Korea and our hope dey in di hands of di pipo, our hope dey strong. Thank you very much," im tok as im end di session.

Crowds block di road to di National Assembly wia MPs impeach President Yoon

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Crowds block di road to di National Assembly wia MPs impeach President Yoon
Some protesters cry for joy wen dem hear di result

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Some protesters cry for joy wen dem hear di result

Di moment dem announce di results, jubilations burst out from di Democratic Party, while members of di ruling party quietly comot from di chamber.

During di vote count, some ruling party lawmakers bin dey fold dia hands in prayer.

All 300 lawmakers participate, wit 204 votes in favor, 85 against, three abstentions, and four invalid votes.

Pipo for Seoul, di capital of South Korea also jubilate for streets as Members of Parliament (MPs) impeach dia president sake of martial law.

Yoon go chop suspension while di prime minister go serve as acting president. Di constitutional court get only six months to rule on di impeachment.

Yoon, bin push dis kontri into political kasala wey no too last long sake of di martial law declaration last week

Yoon bin survive an impeachment vote last weekend and im bin still hold onto power, despite di plenti calls for am to step down.

Yoon bin release statement say im dey temporarily stop im journey.

"I dey temporarily stop my journey," di president tok, as dem sama am wit suspension.

"Even though I stop for now, di journey to di future wey I don waka for di past two and half years must neva stop. I will neva give up. I go take una criticism, praise, and support to di heart and do my best for di kontri until di end."

Yoon and im allies dey currently under investigation for insurrection charges, and dem don ban all of dem from travelling.

Prime Minister becom acting President

Sake of di successful impeachment of Yoon, Prime Minister, Han Duck-soo, go takeova di role of acting president once Yoon collect a copy of di impeachment resolution.

"I go devote all my strength and effort to stable operation of state affairs," na wetin im tok afta dem pass di vote for di National Assembly.

Im dey expected to hold an ad hoc cabinet meeting today, according to Yonhap news agency.

Meanwhile opposition leader for South Korea, Lee Jae-myung tok say "Today na proof say you be di owner of dis kontri," South Korea opposition leader Lee Jae-myung tell protesters wey dey front of di National Assembly.

And a "bigger and tougher mountain" dey ahead, im tok, as im blame "privileged" pipo for di political crisis for di kontri.

Im ginger di crowd to "head towards di victory" togeda.

Han Dong-hoon, wey be di leader of Yoon People Power Party, says im accept today result and take am seriously.

Before MPs start to vote to impeach Yoon, Han bin try to convince di president to consider an "early resignation".

Han bin tell reporters for di National Assembly say di People Power Party (PPP) go "correct wrongdoing and safeguard di constitution and democracy".

According to local media, di Constitutional Court go convene on Monday morning to discuss di schedule of Yoon's impeachment trial.

Di court go also set date for public hearing, though e no dey clear if Yoon go showface and stand inside di box by imsef.

Why martial law dey cause kasala

Di declaration of martial law by President Yoon no only cause political kasala for di kontri, e also raise serious concern around di world.

South Korea na key United States ally. Washington describe am as support of peace and stability for di region.

Di Biden administration bin bet on Yoon, and bring am to Camp David, dem bin praise am for signing agreements wey dem bin tink say go establish a "new era" in relations between bitter north-east Asian rivals, Japan and South Korea.

Washington idea na to bring dis two ogbonge allies closer togeda, to try to get dem to put aside historic grievances and show a united front against di growing influence of China and North Korea.

Now, afta Yoon martial law declaration, many of im decisions, including dis one, fit dey be question and di US fit dey calculate on how much dem fit rely on Seoul from now on.

Dem bin see many pipo wey carry hot packs to warm dia hands

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem bin see many pipo wey carry hot packs to warm dia hands
Many pipo bin come wit lightsticks, wey dem dey commonly seen for K-pop concerts

Wia dis foto come from, BBC/Leeyun choo

Wetin we call dis foto, Many pipo bin come wit lightsticks, wey dem dey commonly seen for K-pop concerts