South Korea opposition file motion to impeach President Yoon

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Kelly Ng, Jake Kwon & Yuna Ku
- Role, BBC News
- Reporting from, Reporting from Singapore and Seoul
- Read am in 5 mins
South Korea opposition lawmakers don start impeachment process against President Yoon Suk Yeol afta im fail to impose martial law for di kontri.
Di kontri bin wake to plenti gbas-gbos wey don dey gada energy throughout di night. Dis na as President Yoon unexpectedly impose martial law, 190 lawmakers gada to squash am wey cause immediate about turn for di move.
Democratic Party afta dem bring di impeachment motion come front call Yoon martial law declaration say e be "insurrectionary behaviour".
Parliament go need vote weda dem go impeach Yoon by Saturday.
Kim Yong-hyun wey be member of di Democratic party central committee, tok say "we no fit allow democracy collapse. Di lives and safety of di pipo need to dey protected".
Di Party wan also charge Yoon wit "crimes of rebellion".
Dem tok say Minister Kim Yong-hyun and Interior Minister Lee Sang-min also get hand inside dis martial law declaration and dem wan follow charge dem too.
School, banks and goment offices for Seoul dey work normally, but protests still dey happun all ova di city.
Dem dey call for di arrest of di president.
South Korea biggest labour group wey dem dey call di Korea Confederation of Trade Unions promise on Wednesday say dem go go indefinite strike till di president step down.

Wia dis foto come from, Reuters
Dis announcement dey come afta di dramatic events wey happun overnight wey make some opposition lawmakers dey break barricade and climb fence to enta di voting chamber.
Hundreds of troops enta parliament afta Yoon bin declare Martial law, wit military helicopters for sky.
Thousands of protesters land for di gates of di National Assembly as 190 lawmakers dodge police lines and force dia way inside to go vote down di order.
Yoon second announcement, say e dey reverse im initial order, cause celebrations from di protesters wey bin tanda outside di South Korea parliament.
On Wednesday, di chief of staff Chung Jin-suk and national security adviser Shin Won-sik submit dia resignation, e no clear if dem go accept dem.
Di presidential office don defend dia first decision to call martial law say na "strictly inside [di kontri] constitutional frame work". On Wednesday, dem tok say di announcement bin dey made of time to reduce damage to di economy and pipo lives.

Wia dis foto come from, EPA
How impeachment dey work for South Korea
Once dem don propose impeachment bill, at least 200 of di South Korea 300 member National Assembly must vote to impeach. Dat vote must to happun within 72 hours.
Once dem don approve di impeachment, di president go immediately dey suspended from office and di prime minister go turn acting president.
Dem go come hold trial for di Constitutional Court wey be nine member council wey dey oversee di South Korea branches of goment.
If six of di council members vote to sustain di impeachment, den dem go come remove di president from office.
Which oda South Korea presidents dem don impeach?
For 2016, dem impeach den President Park Geun-hye afta she bin dey charged wit bribery, abusing state power and leaking state secrets.
For 2004, anoda South Korea president Roh Moo-hyun bin dey impeached and suspended for two months. Di Constitutional Court later put am back in office.
If Yoon resign or dey impeached, di goment go need to hold election within 60 days for di kontri to vote new leader wey go start dia own fresh five year term.
South Korea history wit martial law
For South Korea constitution, di president get authority to call martial law during war, armed kasala or any oda national emergencies.
Di last time dem declare martial law for di kontri na for 1979 wen di kontri long time military dictator Park Ching-hee bin dey killed for coup.
Na group of military leaders, wey General Chun Doo-hwan bin lead declare martial law for 1980 wey ban political activities and arrest pipo wey no wan gree.
Hundreds of pipo bin die and dem crackdown on protesters bifor dem come lift di martial law for 1981.
Dem neva invoke martial law since South Korea turn parliamentary democracy for 1987.
Yoon on Tuesday wen e break dat record say im wan save di kontri from "anti-state forces".
But some analysts don call im move say e to try scata political opposition.
Dem call Yoon lame duck president since di opposition win well-well for di kontri general election dis year for April. Since den, im goment no fit pass di laws wey dem want and now na to just dey veto di bills wey opposition don propose.
Di president approval ratio don hit record low at 17% dis year, even as im and im wife Kim Keon-hee don enta plenti kwanta.
Additional reporting by Woongbee Lee for Seoul and Frances Mao for London









