All corruption charges against former Kogi State govnor Yahaya Bello as court grant am 500 million naira bail

Yahaya Bello

Wia dis foto come from, Yahaya Bello/Facebook

Wetin we call dis foto, Yahaya Bello na former govnor of Kogi State for North-central Nigeria for two terms of eight years
Read am in 5 mins

One Federal High Court for Abuja don grant bail to di former govnor of Kogi State, Yahaya Bello, for one of di corruption charges wey di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) sama on top im head.

Justice Emeka Nwite rule say im dey grant Oga Bello bail in di sum of 500 million naira and two sureties in like sum.

Dis na afta Bello bin plead not guilty to di 19-count charges of money laundering, wia di EFCC accuse say im and three oda accuse pesins do wuruwuru wit Kogi State public funds wey pass 80.2 billion naira.

Di three oda co-defendants na Ali Bello, Dauda Suleiman and Abdulsalam Hudu.

Friday 13 December court case be like say e wan confuse some Nigerians becos earlier dis week, anoda court bin deny Yahaya Bello bail and order say im go remain for Kuje Correctional Centre until di next adjourned date.

However, dat case dey different from dis one so, and di bail wey Justice Nwite grant Yahaya Bello dis Friday no go affect di remand order wey Justice Maryanne Anenih bin issue against am on Monday 10 December.

Oga Bello get at least three corruption cases wey di EFCC file against am bifor three separate courts for Abuja. Here na di cases and how far dem don go:

19-count charge, 80.2 billion naira money laundering mata

Di EFCC suppose arraign Yahaya Bello for dis 80.2billion naira money laundering mata for April 18 dis year, afta dem obtain a warrant of arrest against am on di 17.

Dis na di day wey operatives of di EFCC bin go Bello house for Wuse Zone 4 Abuja, but dem no fit arrest am sake of say di current govnor of Kogi State, Usman Ododo, bin come carry am comot inside im car.

For Nigeria, state govnors get immunity from criminal prosecution for di period dem dey for office, dat na why di law enforcement agents no fit stop Govnor Ododo as e carry Oga Bello comot.

For count one of dis charge, di EFCC say Yahaya Bello, Ali Bello, Dauda Suliman, and Abdulsalam Hudu bin allegedly join bodi to convert more dan 80.246 billion of public funds to personal use.

"Di offence dey contrary to Section 18(a) and punishable under Section 15(3) of di Money Laundering ( Prohibition) Act, 2011 as amended," di EFCC tok.

Justice Emeka Nwite of di Federal High Court Abuja na im dey in charge of dis case, and dis na di mata wia e grant Bello bail dis Friday.

Also remember say dis na di first time Bello dey appear physically to take im plea bifor di judge. Bifor now, im lawyers don file many applications to challenge di jurisdiction of di court to hear di mata.

Bello lawyers bin dey argue say di alleged offences bin dey committed for Kogi State, so di court for Abuja no get jurisdiction to hear am. Dis dragging ova jurisdiction even reach di Supreme Court.

16-count charge, 110.4 billion naira criminal breach of trust and money laundering mata

Dis mata dey bifor Justice Maryanne Anenih of di Federal Capital Territory High Court for Maitama, and dis na di mata wia di trial judge bin deny Yahaya Bello bail and remand am for Kuje prison.

For dis particular mata, di EFCC accuse Bello and two odas - Umar Shuaibu Oricha and Abdulsalami Hudu - say dem use money from Kogi State treasury to buy buildings and apartments for choice areas for Abuja and even abroad, including one apartment for Burj Khalifa, di tallest building for di world wey dey for Dubai, United Arab Emirates.

Justice Anenih deny Bello bail sake of say e file di application wen police neva even arrest am and e neva show face for court. Di judge rule say di bail application dey premature and so she strike am comot.

She, however, grant Oga Oricha and Hudu bail in di sum of 300 million naira each wit two sureties in like sum.

Di mata dey adjourned till 29 January for continuation.

Becos of dis order, Bello go still dey for Kuje prison until January.

17-count charge, 84 billion naira money laundering, misappropriation of fund case

Di EFCC file dis mata against Yahaya Bello on March 14, 2024, bifor Justice James Omotosho of di Federal High Court Abuja.

Also, three oda pipo follow for di accused pesins, namely Ali Bello - Yahaya Bello nephew; Dauda Suleiman and Abdulsalam Hudu.

Trial don already start on dis mata even though Yahaya Bello neva show face for once as di EFCC tok say im dey "at large".

Di EFCC don call at least five witnesses for dis mata and e still dey ongoing.

Odas...

E get oda corruption cases against associates of Yahaya Bello wey concern moving money from Kogi State accounts, but for dis cases Oga Bello no dey mentioned as defendant.

One of dem na di 18-count charges of money laundering and misappropriation to di tune of ova 3 billion naira, involving Ali Bello wey di EFCC describe as Yahaya Bello nephew, and three odas: Abba Daudu, Yakubu Adabenege, and Iyada Sadat.

Di mata dey bifor Justice Obiora Egwuatu of di Federal High Court, Abuja.

On 26 September 2024, during one of di hearings for dis mata, one Jamilu Abdullahi, a bureau de change operator, tell di court how Ali Bello bin bring $300,000 cash to am, to transfer to one American International School for di payment of school fees for Yahaya Bello daughters, according to di EFCC.

Anoda case na di 10-count charges bordering on and money laundering wia di EFCC accuse Ali Bello and two odas of misappropriation of money wey pass 10 billion naira.

Di mata dey ongoing bifor Justice James Omotosho of di Federal High Court for Abuja.