'Dem say na fairy tale wedding I do, but we still dey kampe afta three years'

Wetin we call dis Video,
'Dem say na fairy tale wedding I do, but we still dey kampe afta three years'
    • Author, Tunde Ososanya
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Warri, Delta State

"Dat time dem say na fairy tale wedding I do, to God be di glory, na us be dis today, three years afta."

BBC Pidgin go back to Erumena Akpoghene-Adaiah three years afta di first time she follow us tok.

Erumena bin go viral for social media afta she bin marry for di first time at di age of 64 to Benjamin Akpoghene-Adaiah.

Di 67-year-old woman tell us say di journey wey she bin embark on three years ago dey veri interesting.

"Veri interesting journey oh. If any pesin say any marriage dey wey perfect, na lie e dey lie. Veri veri interesting journey.

"Di journey get up, e get down, e get side, e get dis tin, but veri interesting journey," she tell BBC News Pidgin.

Filmed and edited by Idara Monday