How pesin go like K-drama sotay she make her own movie?

Wetin we call dis Video, How Mummy Wa transform hersef to Korean female lead for hit Nigerian-Korean movie
How pesin go like K-drama sotay she make her own movie?
    • Author, Faith Oshoko
    • Role, Journalist
    • Reporting from, BBC

Di Nigerian-Korean feem, My Sunshine don get both international acclaim and local backlash afta di release for October.

Di movie wey be di first of Kemi Ikuseedun alias Kemz Mama, ‘Mummy Wa’ move into long movie content as producer.

She bin reason am say di Kdrama wey she dey enjoy go be beta way for her to enta di scene as filmmaker.

Di feem bin dey inspired by two of di most popular Kdrama, wey ogbonge actor Lee Min Ho don do, wey be Boys Over Flowers and Heirs.

She bin manage gbab Abdulrasheed Bello, aka JJC Skillz to follow do di feem as well as actual actors wit Korean heritage and Korean interpreters wey helep teach some of di cast members to speak Korean.

Fellow cast member for di feem, Akinsola Esther wey dem call her character, Yewande reveal say di production bin take two weeks bifor the start of di shoot to teach di cast members wey no fit speak Korean how to tok am.

She say, “In terms of speaking Korean, dem try dia best say make dem teach us. Two weeks bifor dat time, we dey learn am small-small. Wen dem see say some, e too long, dem no want make we speak am stretch, dem cut am for most of us.

“Dose wey sabi am normally like Grace, and Adora and Neka dem gio all out, but we wey be say if we tok am na Yoruba dey comot from our mouth, dem tell us say mello.”

But backlash against di feem still comot say e no be like wetin get plot and di Korean no be like say e correct for di movie.

To dat Kemi sama back say, dia Korean go always get accent as na Nigerian dem be and e go hard to sound like Koreans gan-gan.

She also shoot back di pipo wey give am grief on top tori, say e dey hard to squeeze wetin normally be like 20 hours of content to an hour long feem.

Di feem bin also get popular cast members like. from Chinedu Ikedieze, and Debo Adedayo aka Mr Macaroni to Juliana Olayode aka Toyo Baby.

Ms Ikuseedun tok say, “Na dat my mentor wey help me wit JJC Skillz na im help me wit Mr Chinedu cos where I wan take find am, I no get money.

“Toyo Baby! Ah she dey very wonderful and supportive, she dey very eager to even speak di language. Say she wan learn more tins!”

Produced and edited by Faith Oshoko & Idara Monday