Meet Ghana Britain’s Got Talent star Abigail Adjiri
Abigail Dromo Adjiri na seven year-old hearing-impaired dancer from Ghana.
Di talented dancer get third position togeda wit im dance mentor Afronitaa for dis year Britain’s Got Talent wey happun in June.
Since den, di little girl im life don change wia she dey inspire many pipo.
Her mama still dey surprised say her pickin fit to dance to music - but she no dey fit hear if pipo dey tok to am.
Na so afta im win one talent competition for di kontri in 2023, somebody dash am ‘hearing aid’ say make she fit to dey hear small small
Despite her challenge, Abigail don put Ghana on di world map togeda wit im dance partner Afronitaaa for di BGT competition
Di vice president of Ghana bin praise di two for dia “excellent milestone” for di competition.
Afronitaa and Abigail perform wit popular hits, wey include Fuse ODG im song “Azonto,” Beyoncé im song “Run The World,” and Toofan im song “Gweta” among odas
Many pipo don salute Abigail say she get talent wia go carry her go far
At her age, she still dey struggle to hear wia im no fit to tok
But im mama Evelyn Darpoh happy say she neva give up on her child as she see say she get disability.
Among her three pickins, na only Abigail get disability.
Evelyn wey be proud mama say she want make oda pipo know say if pesin get disability e neva mean say dem dey useless
“Disability no be inability, make una find wey talent your pickin get, make una help am to develop am.”
Abigail don achieve many tins at seven years - im mama believe say she fit do more to make dia family and di kontri proud






