How early childhood education fit help your child develop wella
- Author, Kareemot Salami
- Role, BBC News, Lagos
Two out of three children age three to five dey engage for early learning activities for house.
E dey lower for Northeast by 49 percent, Northwest by 55 percent and for di poorest children 46 percent, one Unicef data tok.
Dis na one of di reasons why experts dey call for more investment for early childhood education. Dem say e dey important for Nigeria development.
Studies don also show say early learning experiences fit get solid impact on pikin cognitive, social, and emotional development.
Sabi pesin for early childhood learning, Caroline Popoola wey dey work wit children wey dey under age of five for interview wit BBC Pidgin say for evri kontri, evri child matter.
“Weda na three months old or 16 years old child na child, di most important tin na to catch dem young, make we start to work wit dem around dia emotions, problem solving, wen you catch dem young you believe say wen dem become older dem go become proper adult”.
“Research show say evri child for different age dey get different tins wey dem go learn for different age to begin teach children age two continents in di world no mean say dem sabi to dey cram.
"Invest for early childhood education no be just social responsibility; na strategic investment for di nation future. Children wey receive quality early childhood education dey more likely to succeed for school, get better health outcomes, and contribute positively to society."
Halimotu-Sadia Omowumi Obani wey be grandmama say her own believe na say childhood learning start from di day pesin born pikin.
My pikin, since 41 days I don dey teach dem, wen I wake dem I go bathe dem, give dem food, na part of teaching be dat.
“Any mama or papa wey wan get rest of mind wen im grow up no go leave teaching for school teachers, you go don begin teach your pikin from house, so dat at di end of di term or end of year wen dem wan do anytin, teachers sef wen you reach dia school dem go give you gift say your pikin get home training.”
Ms Halimotu add say unlike wetin some new generation mothers believe, make pikin begin learn from home no be old school method, na very important part of early childhood education.
As African mother, Ms Halimotu believe say part of childhood learning na also wen pikin recognise say visitors dey house and adjust how dem dey behave.
33 years old Obiageli Ibokwe wey be mama of four pikin believe say collaboration between parents and teachers dey important for early childhood education.
“As young parent wey I be wetin I believe be say to train pikin no be only teacher work, na from im house na im di learning go start, parent and teachers go dey work hand in hand to make sure say dat pikin turn out to be better pikin.
Obiageli believe say potty training, how to greet to ask question etc na part of education and e suppose start from house.
“As I take understand, to teach pikin how to use potty, to do small small tins for house all of dem na education, no be only to write be education, everitin wey human being suppose sabi na education for small pikin dem”.
Key benefits of early childhood education
Sabi pesin on childhood learning tok about di ogbonge benefits wey dey childhood education.
Cognitive development: Early learning dey stimulate child brain development, wey go help dem improve problem-solving, critical thinking, and language skills.
Social and emotional development: Pikin dem wey engage for early childhood programs dey more likely to develop strong social skills, empathy, and self-regulation.
Academic achievement: Research show saypikin dem wey don participate for early childhood programs dey more likely to perform better for school and for all levels.
Economic benefits: To invest for early childhood education fit bring ogbonge economic returns as e go reduce di need for need for any kind remedy for education and increase productivity for workforce.
Four tins wey Parents fit do to help early days of childhood learning

Caroline Popoola futher tok say e get four tins wey parents, teachers and schools fit dey do as dem dey wait for govment help. She bin list:
Communicate: Di sabi pesin say e dey good make parents dem and teachers dey communicate about dia pikin development
Volunteering: Dis na wen parents act role of teacher for dia pikin school. “ dis go help dem see wetin teachers dey go through” and dem go fit know wia to come in”.
Parents/ Teachers association: Dis na wen parents come togeda say dem wan do better tins like buy books, buy furniture or build library for school sake of dia children.
Donations: To fit carry out dia plans to help di school, parents go come togeda raise money to fund school projects. Dem fit also do like sales of small-small items for di school yard to raise di money. A ll dis na wetin we dey call collaboration of schools and parents to fit help childhood learning to get better.
Despite say e get plenti benefits, access to quality early childhood education still na serious challenge for many Nigerian children.
Di gbege dey common amongst pikins wey dia parents no too involve for dia education and also get financial disadvantage.
To address dis matter, goment and sabi pipo on Early Childhood education need do more patnership wey go help expand early childhood education programs and improve di quality.
If goment invest for early childhood education, Nigeria go fit build stronger, more equitable, and prosperous future for im young pipo Popoola explain.
Although, di Nigeria education policy sabi say early childhood care and education (ECCE) dey important as foundation for lifelong learning.
Di kontri bin also launch im National Early Childhood Development Policy for 2007, wit aim to provide one ogbonge approach to early childhood development.
Despite say dis policies dey ground, challenges still remain for di area of implementation of di early childcare education plan.






