Ghana authorities worry as nurses wey enta Barbados on government programme dey japa
Ghana authorities worry as nurses wey enta Barbados on government programme dey japa
As Ghana dey prepare to send third batch of nurses to Barbados as part of one agreement between di two kontris since 2021, di nurses association dey worry say dis nurses neva dey return home afta dia two-year contract.
Sabi pipo believe say di economic wahala and oda poor conditions of service don dey push dem away.
For dis nurses, Barbados na stepping stone for dem to japa to US, Canada, Australia and oda kontris.







