'Say I dey barb na becos my papa hand over to me becos e no get male child'

Wetin we call dis Video, For Northern Nigeria e dey very rare to see woman dey do barber work
'Say I dey barb na becos my papa hand over to me becos e no get male child'
    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano

For Northern Nigeria e dey very rare to see woman dey do dis kain tin, some pipo even think say no woman fit do am.

Na dis wan make am a hard for Hassana as some pipo dey see her as pesin wey dey do wetin dem sabi wit only men for dat region.

As for barbing, a barber must touch di head of a pesin wey e dey barb but Hassana dey break di old culture wey say woman no suppose touch man head.

For Northern Nigeria and for Muslims e no good for man or woman dey get contact wit each oda unless dem marry.

But even wit dis e no stop Hassana from becoming a professional for dis kain work as she tok say her family bin dey do am since her great- grandparents, wey mean say she inherit am from her papa.

Filmed and edited by Mobolaji Olatunde