‘Pipo mock me as Prophetess wey no fit deliver hersef’ – Woman wey born six children at di same time share her tori
- Author, Karina Igonikon
- Role, Reporter
- Reporting from, Port Harcourt
For 26 year old Deborah Enejueteri, di birth of her sextuplets siblings - three boys and three girls - na dream come true for her.
E don tay wey she dey pray for her mama to born oda children so she too go get brothers and sisters.
Her mother, born di sextuplets after she undergo IVF treatment.
Deborah go share di testimony of di birth of children for Church wey make di tori trend as na pikin wey dem don dey wait for since.
She tell BBC Pidgin say her mother born her during her teenage years so na only she and her dey before she come marry nine years ago.
Prophetess Grace Odjiefo na di mama of Deborah and di sextuplets. She say pipo mock her as Prophetess wey no fit deliver hersef.
She say di pregnancy journey no easy becos she bin sick well well during di period.
Filmed and edited by Idara Monday






