‘I sacrifice social media for months to take achieve straight As for my WAEC’

Wetin we call dis Video, Toluhi Jesujoba share her tori wit BBC Pidgin how her hard work pay off
‘I sacrifice social media for months to take achieve straight As for my WAEC’
    • Author, Chukwunaeme Obiejesi
    • Role, Journalist
    • Reporting from, BBC

Toluhi Jesujoba share her tori wit BBC Pidgin how her hard work and sacrifices bin pay off as she get straight A1s for her 2024 Waec exam.

Di 16-year-old student tok say she give up social media for many months to focus on her studies and she happy wit di outcome.

Toluhi result dey even more remarkable sake of say e happen for a year wen student performance for WAEC bin poor well-well.

“I put aside all dose Instagram, Twitter, I dey focus on my goal. I bin get am for mind say I go A’s but I no sure say na eight As I go make,” she tok.

Toluhi result dey even more remarkable sake of say e happen for a year wen student performance for WAEC bin drop significantly.

Out of more dan 1.8 million secondary school students wey write di 2024 Waec exam for Nigeria, na just about 72.9% manage to get five credits for five subjects including English and Maths.

Filmed by Idara Monday