‘Many pipo don ripe for marriage but dem no dey see partner’ - Meet di man wey fit help you find husband or wife
‘Many pipo don ripe for marriage but dem no dey see partner’ - Meet di man wey fit help you find husband or wife
- Author, Mansur Abubakar
- Role, Journalist
- Reporting from, Kano
Rabiu Ado wey pipo dey call ‘Mai Da lilin aure’ due to di nature of im job wey for Hausa mean say e dey help pipo find wife or husband.
Di man tell BBC News Pidgin say e learn di work from im mama and na some tin e go like pass on to im own pikin.
Rabiu say e don help over 500 couples marry and counting.
“Nothing I like for dis world pass to join two pipo togeda for marriage. Na my biggest joy.
“At di same time nothing I hate for dis world like seeing pipo divorce. I hate am wella.
“I go like do dis work for di rest of my life.”
Rabiu tok say evri day na up to five clients evri day wey dey come meet am to help dem find wife or husband.
For Kano e get some oda pipo like Rabiu wey dey into dis work of Mai Dalilin Aure.

Video by Monday Idara






