'I love to chook my nose and my face'

Wetin we call dis Video, Body piercing: 'I love to chook my nose and my face'
'I love to chook my nose and my face'

Meet di Nigerians, wey love to pierce dia body. For dis exclusive interview with BBC Pidgin, two Nigerians tok about dia body piercing experience.

"Its just like wen pesin wake up in di morning and wan wear blue shirt, me I wan chook my nose, chook my face.

Pipo dey look down on me like say I be riff-raff but I be family man, I dey married with two children. I get business, I dey pay tax and I be regular man.” One of di respondents tok.

Dem tok about how dem fall in love with di act, and how pipo dey react to di way e make dem look.