Senate order probe into FCT demolitions, to invite Wike afta Ireti Kingibe chook mouth for im mata

Senator Ireti Kingibe and Nyesom Wike

Wia dis foto come from, Nyesom Ezenwo Wike/Facebook, @senatoriretikingibe/Instagram

Read am in 5 mins

Di Nigeria Senate on Thursday say dem go summon di Minister of di Federal Capital Territory (FCT) Nyesom Wike.

Dem dey invite am sake of say dem wan chook eye for di demolitions wey dey happun for di Federal Capital Territory (FCT).

Di upper chamber don set up investigative committee to look into di mata.

Di committee get di responsibility to also invite Wike to appear bifor dem and explain di reasons why im dey demolish structures for Abuja.

Dis demolitions don make many pipo no get houses and roofs ova dia heads.

Na Senator Ireti Kingibe of di FCT Senatorial District move di motion as she express concern ova di "illegal demolition of structures" for di Nigeria capital.

She add say make di house call am to stop di "illegal demolitions" sharp-sharp.

Di Senate agree to set up investigative committee to chook eye into di demolitions and report back to dem.

Di upper chamber also summon di Managing Director of Julius Berger Nigeria PLC sake of say di company bin refuse to honour dia invitations to provide details on di Odukpani-Itu Highway project.

Di Odukpani-Itu Highway dey for Cross River and Akwa Ibom states. E dey connect di town of Odukpani for Cross River State to Itu for Akwa Ibom State.

E dey also serve as a critical link for transportation and economic activities for di south-south region.

Di Senate also agree to set up investigative committee to chook eye into how di company dey neglect and refuse to honour invitations and provide details of dia role for di project, even though dem don receive substantial public funds wey be ova 18 billion naira.

Di Senate also condemn how Julius Berger and oda pipo and companies no dey gree honour lawful invitations.

Di Red chamber say e constitute contempt of di National Assembly and e dey undermine constitutional authority.

Di Senate also invoke di constitutional powers to issue a warrant of arrest wey go force di Managing Director of Julius Berger to attend dia meetings at a rescheduled investigative hearing.

'Make heaven fall' - Wike

Meanwhile, Nyesom Wike don defend why im dey demolish properties for di capital city. Im tok say dem no go fit bend am wit blackmail.

According to di FCT minister, di structures wey im dey demolish through di Federal Capital Development Authority (FCDA) na properties wey pipo build illegally for goment lands.

"Make I use dis opportunity to tell Nigerians and residents of Abuja say, we no dey fear blackmailing," Wike tok.

Na wen im dey distribute operational vehicles to security agencies for di FCTA Secretariat for Abuja on Thursday im yarn dis one.

"In fact, you no go dey for dis kain position and say you no fit dey blackmailed particularly as e concern dis Abuja. Plenti landgrabbers dey hia. Some of us don come to put our feet down. Make heaven fall. E even beta say heaven come down now so dat we no go dey do fasting again to go heaven."

Abuja residents and Nigerians dey complain well-well, some don do protests but Wike no gree for anybody as im vow to go afta more buildings wey pipo build illegally and shanties.

"We go stop anybody wey tink say dem go take goment land for whatever reason wit formal approval. We no go look your face. If you like be civil rights activist or a television personality," na wetin Wike tok for di event.

"Wetin dey wrong dey wrong; no amount of blackmail go stop us. Pipo dey take goment property witout approval or documentation." Wike conclude.

Wike and FCT demolitions

Demolition of house, estates and shanties no be new tin for Abuja. Wen Nyesom Wike enta office as FCT minister di same day oda ministers enta office for August 2023, im make am clear say im go demolish illegal structures.

Afta Nigeria President Bola Tinubu inaugurate all di ministers, dat day im tell all of dem say make dem work to restore public faith in goment.

Di FCT minister take dis word serious as im also address all staff of di Federal Capital Territory Administration (FCTA)

For im first speech, im send warning to Abuja residents wey dia properties (buildings and structures no dey inline wit di masterplan of Abuja.

Wike add say im dey ready to revoke any property licence or certificate of occupancy from anybody weda di pesin na big man or not as im major objective na to bring Abuja back to di original master plan.

"If you know say you build for wia you no suppose to build, e go go down. E go go down. Be minister of anywia, be ambassador. If you bin don develop wia you no suppose to develop, your house gatz go down," Wike tok.

Di former Rivers State govnor no end dia o, e say, "Di pipo wey don take ova di green areas to build, our parks gatz come back, di green areas gatz come back. If you hate green, you gatz hate yoursef. So, if you get anybody wey dey involved, wey don take ova di green areas or wey don take ova di parks, to wia una dey use as restaurants, we no go accept am."

Since Wike start work, di Federal Capital Development Authority (FCDA) dey always dey busy from one demolition site to anoda.

Some of di places wey demolition don hit na some shanties and estates.

According to Wike, some of di structures dey illegal and e dey pose security risks, and di oda demolitions na for properties of pipo wey build for goment land.