Two court orders and di political kasala for Rivers state politics between Wike and Fubara

Governor Sim Fubara dey present 2024 appropriation bill

Wia dis foto come from, Rivers state government

Federal High Court for Abuja don order all parties for di Rivers State Assembly crises to maintain status quo.

Di court for ruling wey Justice J. O. Abdulmalik deliver say make di parties no take any further steps, until di determination of one application wey dey seek to stop Governor Siminialayi Fubara from re-presenting di already passed 2024 budget of di State before di legislative house.

Justice Abdulmalik fix 28 February 2024 to hear di application wey some elders bring before di court.

Dis court order come just afta anoda Federal High Court for Abuja bin bar govnor Siminialayi Fubara from interfering wit Rivers state assembly wey Martin Amaewhule dey lead.

Di Court also bar National Assembly from entertaining any request from di govnor to take over activities of di Rivers Assembly.

Di Court den order oga Fubara to release all di money wey di state assembly suppose get becos if e no do so, e dey go against di principle of separation of powers as dey di constitution.

Justice Omotosho make dis orders for di case wey Amaewhule and di lawmakers sue di govnor.

Di Court further rule say di purported presentation and subsequent passage of di Rivers State 2024 appropriation Bill "by a few members of di State Assembly na nullity and e dey void ab initio".

Dis na di latest for all di political kasala wey dey happun for Rivers State, South-South Nigeria.

Di govnor and im godfather, Nyesom Wike wey be di current minister of FCT dey fight over who go control di state.

Case bifor Justice Abdulmalik

Two speakers of RSHA

Wia dis foto come from, RSHA press

Wetin we call dis foto, Di Federal High Court for Abuja recognize Martins Amaewhule-led Assembly

Di plaintiffs for dis matter na a member of di Rivers State House of Assembly wey dey represent Bonny State Constituency, Victor Oko-Jumbo - along wit Senator Bennett Birabi, Senator Andrew Uchendu, Rear Admiral O.P. Fingesi, Ann Kio Briggs and Emmanuel Deinma.

Dia team of lawyers led by Olukayode Ajulo SAN, approach di court, and ask di court to declare di seats of 27 lawmakers for di State wey defect from di Peoples Democratic Party, to di All Progressives Congress vacant.

Dem kwesion how constitutional di peace agreement dem alleged say President Bola Tinubu compel govnor Fubara to ente into wit di immediate past governor of di state and current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike.

Dem maintain say di said agreement wey bin dey signed on December 18, 2023, no only dey illegal, but e amount to di violation of di 1999 Constitution, as amended.

Dem want make di court to among oda tins, determine weda President Tinubu, Governor Fubara and di Rivers State Assembly, get di rights and dey entitled to enta into any agreement wey get di effect of nullifying di constitutional of di provisions of Section 109 (I) (g) and (2) of di 1999 Constitution, as amended.

How dis court mata start?

On 11 December 2023, a faction of di Rivers State House of Assembly and Martin Amaewhule bin file suit against Fubara, di National Assembly and odas.

Dem also sue di House of Representatives Speaker, House Deputy Speaker, House Majority Leader, House minority leader, Clerk to di National Assembly as di 6th to 10th defendants respectively.

Also, dem sue govnor of Rivers State, Attorney- General, commissioner of finance, accountant-general, Rivers state civil service commission, Inspector-General of Police and Edison Ehie, wey dem bin list as Rivers State House of Assembly speaker for di suit, as di 11th to 17th defendants.

Amaewhule ask for order of injunction wey go restrain oga Fubara to take over di performance of di functions of di state assembly.

All di matter start afta tori leak say plans to impeach di govnor. Dis one lead to serious gbege between gi govnor and majority of di Lawmakers wey dey loyal to di FCT minister.

Dis one cause series of protests for di state wey make di president Tinubu intervene for di mata.

Di parties reach agreement wey di president offer to make peace - but di reslution of di president no sweet many pipo bele becos of belief say e favour di minister.

Lady Justice
Wetin we call dis foto, Martin Amaewhule approach di Federal High Court Abuja for December 2023