Typhoon Kalmaegi land Vietnam afta e kill 114 pipo for Philippines

High waves for central Vietnam beach as two pipo wey dry drive motorcycle dey look

Wia dis foto come from, DAU TIEN DAT/EPA/SHUTTERSTOCK

Wetin we call dis foto, Pipo bin dey watch as waves dey crash di central Vietnam beach as di typhoon enta Vietnam earlier on Thursday
Read am in 6 mins

Typhoon Kalmaegi don land for central Vietnam afta e comot from Philippines wia e kill ova 100 pipo.

Typhoon Kalmaegi na di 20th tropical cyclone to hit Philippines dis year and e bin enta di kontri on Tuesday.

Di typhoon enta di whole town wit flood wey kill at least 114 pipo even though di numbers dey expected to rise.

Dem bin evacuate tens of thousands of pipo, especially di ones wey from central areas including di island and tourist hotspot of Cebu - early on Thursday.

Philippines President Ferdinand Marcos Jr declare a state of emergency wia im bin announce say di typhoon don gada strength and e dey expected to hit Vietnam later on Thursday.

Im even tok say di typhoon fit generate waves of up to 8m (26 ft) for di South China Sea, according to di weather bureau for Vietnam.

Dem tell thousands of pipo wey dey live for di coastal communities to evacuate bifor di typhoon land.

Vietnam Deputy Prime Minister Tran Hong Ha say Kalmaegi na "very abnormal" storm wey dem need to treat sharp-sharp.

Vietnamese govment online portal bin dey share figures about di typhoon windspeeds wen e bin land early Thursday.

Dem tok say maximum sustained winds of up to 92 mph (149 km/h) bin dey.

Di Vietnamese national weather forecaster say hundreds of localities for seven cities and provinces dey at risk of flooding and landslides for di next six hours, according to one notice wey dem bin issue earlier on Thursday.

Reports dey of damage from several provinces wey include roofs wey don tear and fall from dia homes, glass panels for hotels wey don scata, and trees wey don uproot from ground or wey fall along city streets and rural roads sake of di power of di winds.

Dem cancel more dan 50 flights for Vietnam according to national flag carrier, Vietnam Airlines.

About eight airports in the central region, including the international airport for Da Nang, don either suspend operations or dey prepare to do so, aviation authorities tok.

Typhoon Kalmaegi don also hit Vietnam coastline, and bring di winds up to 149 kilometres (92 miles) per hour, according to reports from online Vietnamese newspaper VnExpress.

Trees don fall for main roads and e dey block access, while windows for hotels for di Quy Non area don break.

"Di storm don enta land, for di provinces of Dak Lak and Gia Lai," na wetin di environment ministry bin tok for statement wey various outlets quote, including di AFP news agency.

Mix of residents and emergency workers we wear nose mask for rubble

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Pipo gada for environment wey be like wia landslide happun
Map wey dey show wia Typhoon Kalmaegi dey expected to pass.

Meanwhile, di Vietnam military don deploy more dan 260,000 sojas and personnel, along wit ova 6,700 vehicles and pieces of equipment, including six aircraft, to help wit storm relief efforts.

All units dey on standby for search and rescue operations as dem ready to respond to di typhoon.

Viettel, one military-owned conglomerate, don also announce say dem go support di rescue efforts wit fly-cams - technology wey dem go use. Dis technology no dey common for Vietnam disaster relief operations.

Govment for di kontri also close six airports in total sake of di storm. For statement, officials say dem close five in particular sake of say e affect hundreds of flights for Vietnam.

Di airports na Buon Ma Thuot, Pleiku, Tuy Hoa, Chi Lai Phu Cat, Lien Khuong.

Foto of woman wey dey carry black bag for her head as she dey waka inside flood water.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Vietnam dey already battle deadly floods, wey don kill at least 35 pipo

Bifor Typhoon Kalmaegi land, Vietnam bin dey battle wit floods and high rainfall dis week.

Riverbanks wey burst bin cause serious flood for some of of di most popular tourist spots for di country including di city of Hue wey Unesco bin list and historic hotspot Hoi An - wia dem bin picture residents wey dey waka for di city wit wooden boats afta di Hoai river bin overflow.

At least 35 pipo don die, according to one recent statement from di national disaster agency.

Vietnam environment ministry also say more dan 100,000 homes dey flooded and more dan 150 landslides na im dem report.

According to local media reports, PM Pham Minh Chinh bin do one online meeting to direct di emergency response.

"We must reach isolated areas and make sure say pipo get food, drinking water, and essential supplies. Make dem no leave anybody hungry or cold," dem quote am.

Authorities bin warn say communities wey dey for di seaside for Vietnam go be di most hit.

Di sea-level rise of 4 to 6m (13 to 20ft) for at least two provinces fit capsize boats and destroy fishing farms, according to one forecast wey one senior official for di Vietnam National Center for Hydro-Meteorological Forecasting bin issue around 16:00 local time (9:00 GMT)

Meanwhile, deputy director Nguyen Xuan Hien say Typhoon Damrey - wey bin hit Vietnam for 2017 wey bin no even strong like Kalmaegi bin still cause serious damage to coastal communities - and make dis one serve as warning, as dem beg di residents to dey alert.

Thailand don dey also perpare for di impact of dis storm. Local officials don laready warn dem of flash floods, landslides and river overflows.

Wetin typhoon Lamengi cause for Phillipines

For Philippines, emergency responders still dey work to find survivors afta di typhoon waka comot from di kontri.

Mud bin sweep through buildings wey include branches of McDonalds.

Pipo gada for one house wey be like camp afta flood pursue dem from dia homes.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kalmaegi don displace more dan 400,000 pipo for Philippines
Emergency workers wear helmets dey try retrieve deadibody dem for landslide site

Wia dis foto come from, EPA/SHUTTERSTOCK

Wetin we call dis foto, Emergency responders still dey work as dem dey try to retrieve deadibody for site wey landslide hapun for Cebu City