Wetin be di US Golden Dome defence system wey Canada also dey interested in?
Di US President Donald Trump don select a design for "Golden Dome" missile defence system wey e tok say go dey operational by di end of im tenure for office.
Few days afta Trump bin return to di White House for January, e unveil im intentions for di system wey e say go aim at countering "next-generation" aerial threats to di US wey include ballistic and cruise missiles.
Na about $25bn (£18.7bn) be di new budget bill for di defence system, but goment say e fit end up 20 times more dan dat amount ova decades.
One briefing document wey di Defense Intelligence Agency recently release say missile threats "go expand in scale and sophistication", wit China and Russia actively designing systems "to exploit gaps" wey dey di US defences.
How dis 'Golden Dome' defence missile take come be say, seven days into im second administration, Trump order make di defence department submit plans for a system wey go defend against aerial attacks wey White House say na "di most catastrophic threat" wey dey face di US.
Wetin be di Golden Dome defence system?
Di 'Golden Dome' defence system go consist of "next-generation" technologies across land, sea and space, wey go include space-based sensors and interceptors, according to wetin Trump tok for di Oval Office on Tuesday.
According to Trump, di system go dey capable of 'intercepting missiles wey dem launch from di oda side of di world, or launched from space'.
Dis defence system wey di US dey introduce bin get di inspiration from Israel Iron Dome, wey di kontri dey use stop rockets and missiles since 2011.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Golden Dome go dey many times bigger and get design to combat a wider range of threats, wey go include hypersonic weapons able to move faster dan di speed of sound.
Also, di Golden Dome go get fractional orbital bombardment systems wey fit deliver warheads from space.
Shashank Joshi, defence editor for Economist, tell di BBC say di Golden Dome go work by using thousands of satellites to spot and track missiles and den use interceptors in orbit to fire di missiles as dem dey take off and take dem out.
On Tuesday, Trump say di programme go require initial investment of $25bn, wit a total cost of $175bn ova time.
Why Canada dey tok wit US to join di Golden Dome defence system
Trump tok say Canada don say dem wan dey part of di system.
Di Canadian goment don come out to say dem dey tok wit di US ova di plan to join di proposed "Golden Dome" missile defence system, wey go kwanta "next-generation" aerial threats.
Prime Minister Mark Carney office say "active discussions" dey go on between Canada and di US ontop security mata, wey include di ones wey dey bifor and new programmes like di Golden Dome.
Canada interest to join di proposed Golden Dome system dey come sake of dia ongoing trade and security negotiations between di two kontris. And dis na afta Trump bin threaten tariffs on Canada.
Audrey Champoux wey be di tok-tok pesin for PM Carney say Canada get mandate to negotiate comprehensive new security and economic relationship wit di United States.
"To dat end, di prime minister and im ministers dey get wide-range and constructive discussions wit dia American counterparts," she tok.
However, she add say e go dey too early to sabi if Canada go pay into di system or how di system go work for di kontri.
Meanwhile, Canada and di US na already partners on di North American Aerospace Defense Command, known as NORAD.
NORAD na system wey dey responsible for aerospace and maritime surveillance, warning and defence of di region, and wey fit detect and shoot down cruise missiles.















