Police tok how officer take kill Ibadan teenager, family react – wetin dey happun next

Late Kehinde Paul Alade

Wia dis foto come from, Odunayo Alade

Read am in 6 mins

Di police officer wey fire di shot wey kill teenager for Ibadan don chop arrest.

Oyo State Police Command say dem dey investigate one incident wey claim di life of di young boy for Ibadan.

Di police for one statement wey di state tok-tok pesin Adewale Osifeso sign tok say di tragic incident happun during one joint traffic enforcement operation wit di Oyo State Traffic Management Authority (OYTMA).

Officers bin dey try stop one black Honda Accord wey one Odunayo Alade dey drive - di papa of di late young Kehinde Paul Alade as e bin dey drive against traffic (one-way), police tok.

Osifeso add say "Rather dan comply wit lawful directives, di driver accelerate towards di enforcement team in an attempt to escape arrest, jam two OYTMA vehicles and one Police Buffalo Patrol truck."

Dem further explain say di driver reportedly break through barricades wey police bin mount for road, and kontinu to drive recklessly and endanger lives.

Police say di driver conduct bin make officers suspect am to fit be criminal activity or a case of abduction and dem begin chase am.

Na during di chase wey one police corporal bin discharge firearm aimed at di tyres, but di bullet miss and strike di deceased wey bin dey inside di car at di time.

All attempts to save di deceased life bin no work.

Commissioner of Police, CP Johnson Adenola, psc, immediately deploy officials to di scene and oda strategic locations in Ibadan to ensure public safety.

Police say dem don take di officer wey fire di shot into custody and oda members of di team dey cooperate wit investigation.

Viral videos and fotos of a young boy wey police officer allegedly shoot dead for Ibadan, Oyo State, southwest Nigeria, don spark serious anger online and gbege within di region.

According to reports, on Tuesday 20 May, 2025, police officer for Ibadan, Oyo State bin allegedly open fire while dem dey chase one particular car around one popular market for di city.

Sadly, di bullet bin hit one young student identified as Kehinde Alade wey dey inside im papa car wit im brother as e dem dey on dia way to school for early mor-mor.

Di papa of di boy, Odunayo Alade, tell BBC News Pidgin how di incident take happun for Alakia area of Ibadan.

E say: "I bin dey inside di vehicle dis morning dey carry di boy and im brother at di Alakia area. In di process, dem hit my vehicle for di back. While in a state of confusion, I bin dey reverse my vehicle. Suddenly, one police officer for di area just shoot my vehicle. Bifor I know am, di police bullet hit Kehinde. I no even take note, but im brothers call my attention to di fact say blood say blood dey gush out of im bodi.

"We rush am am to one hospital, but di bullet don penetrate im stomach and come out from di oda side."

People gathered at the secretariat where the boy who was shot was taken to

Oga Alade, wey cry wit plenti tears tok how im bin dey take care of di deceased boy and im brothers since dia mama leave am years ago.

Eyewitness tok wetin e see

One eyewitness wey follow BBC News Pidgin tok say di officer bin dey pursue one vehicle wey dey run along di Gbagi Market Road for Alakia and dem open fire so dem go fit stop car and dia suspect.

E say one of di bullets bin miss di target and hit di schoolboy wey dey inside im papa vehicle wit im broda.

Dem immediately rush di boy go Welfare Hospital but dem declare am dead on arrival.

One security officer wey dey work around di area explain how e happun.

E say, "Today, May 20, 2025, around 07:30 am, stray bullet by one officer of di Nigeria Police Force bin hit a boy for airport junction.

"Di policeman wey dey involved run inside Samuel Ladoke Akintola Airport for safety. Dis make pipo go di airport gate to protest and demand justice as dem tok say di boy don die for hospital."

During protest wey start sake of di incident, sympathisers and traders take bodi of di boy go di Govnor Office for Oyo State Secretariat, Agodi, Ibadan.

Dem say make Govnor Seyi Makinde chook mouth for di matter.

Di assistant to Oyo State Govnor on Security Matters, CP Sunday Odukoya (rtd), beg di parent, family members and di protesters, say dem go serve justice ontop di matter.

Dem carry di deadi bodi to mortuary.

Meanwhile, di Police Public Relations Officer for Oyo State, Adewale Osifeso, neva respond to message and e neva pick im call.

Oyo goment react

Di Oyo State send message give di family of di secondary school boy wia dem describe di incident as "sad, shocking and painful".

One statement wey di Special Adviser (Media) to Govnor Makinde, Dr Sulaimon Olanrewaju bin sign, say di incident bin happun during di routine traffic infraction operation for Alakia old road, Ibadan.

"Di state goment go work wit di Oyo State Police Command to investigate di matter and ensure say dem serve justice.

"Goment say di incident dey totally avoidable, as wetin start as traffic offence wit di father of di slain boy driving against traffic, and e result in di loss of innocent life," di statement tok.

Di state goment add say police no dey chase any internet fraudster wen di incident happun.

Dem say police bin dey assist Oyo State Road Traffic Maintenance Authority (OYRTMA) to catch traffic offenders.

"Contrary to claims say di incident occur while di police dey chase suspected internet fraudster, di incident actually occur during a routine operation against traffic infraction, carried out by men of di Oyo State Road Traffic Maintenance Authority (OYRTMA)."

According to di goment, OYRTMA officials in conjunction wit team from di police, bin embark on di traffic operation on Alakia old road sake of complaints from residents ova constant one-way traffic violations wey don lead to deaths and life-threatening injuries for di axis.

Di goment say di father of di deceased boy bin "drive against di traffic at around 7.30 a.m. and one policeman bin allegedly aim a shot at one of di tyres of di car but e miss di target".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post