'I live my three children for house go Church, wen I come back na dia corpse I see inside freezer'

Wia dis foto come from, SAMUEL EJEZIE
"I live my three children for house go church, wen I come back, na dia corpse I see".
Dat na tori of Madam Chikazor Ogochukwu Ejezie wey loose her three children same day for Nnewi Anambra state.
Tori be say she live di three children for house, go exam for Ihiala axis of di state, but wen she come back, she no see any of dem and dia house dey open.
Di male pikin among dem dey three-years-old, while di two girls dey seven and nine-years-old respectively.
According to her she been relax for house dey expect say dem go play finish come back, but wen evening don reach and she no see dem, fear enta her body wey make am raise alarm.
"I reach out to my husband friend wife wey her pikin dem dey follow my own go church, but she say her own kids no go cathechism dat day. I ask am weda my children dey her house, she say no," na so she tok.
She add say "one of my neighbors tell me say im see two youths wey come my compound earlier in di day and e also see wen my daughter bin come out of di compound go buy sometin and come back house.
How dem find di deadi bodi

Wia dis foto come from, SAMUEL EJEZIE
After dat dem begin search for di kids everywia but no see dem. Na later dem see di dead kids inside freezer for inside dia house.
Papa of di kids Samuel Ejezie tell BBC say im wife go exam for Our Lady of Lords Ihiala, as e come back at about noon, e no see any of di kids.
E say "normally if my wife come back di kids go come out, hug am to receive am, but dat day as she come back evriwia dey open and dia shoes dey littered evriwia".
E say na only dem and di landlord mother dey live for di compound, but di woman no dey house wen di incident happen.
"Oda pipo wey dey stay for di compound na nursing students, but I sure say dia hands dey clean for di matter cos me and dem no get any form of problem " na so e tok.

E neva still clear how di children take enter di freezer or who put dem dia as nobody don gree say e follow witness di incident.
Police for Anambra confam di report say dem don begin investigation.
Cases of children deaths don boku recently.
Reports bin fly around few weeks ago of wia dem find corpse of three children inside parked car for Nise, same Anambra state.






