Wetin dey inside di new UK-EU deal wey set out post-Brexit relations on key areas

Wia dis foto come from, EPA
- Author, Sam Francis
- Role, Political reporter
- Read am in 4 mins
UK and di EU don reach one new deal wey highlight post-Brexit relations on areas wey include fishing rights, trade and defence.
Dem go explain beta di full details later.
But dia na wetin we know say dey di deal so far.
Fishing
- One new deal wey go keep di current status quo, UK go continue dey give EU boats continued access to UK waters until 2038
- Di 2020 Brexit deal, wey see di UK regain 25% EU fishing quotas, dey due to end next year
- UK go continue to agree on yearly quotas wit di EU and Norway and issue licences to control who go fish for dia water
- £360m "fishing and coastal growth fund" to invest in new technology and equipment
Farming exports
- In return for extending current fishing rules, UK don secure one deal to reduce checks on food exports go EU
- Dem go drop di plenty routine border checks on animal and plant shipments to and from di EU
- Di new sanitary and phytosanitary (SPS) agreement mean say UK go fit sell raw burgers and sausages for di EU for di first time since Brexit
- Under di deal, e dey expected say UK go follow EU rules wey dem no write – wey di European Court of Justice dey oversee. But dem fit break away if dem follow di same standards and no spoil EU trade
Defence and security
- One formal UK-EU defence and security pact don dey established
- UK and EU officials go meet every six months to tok about defence and foreign policy
- Both sides go coordinate on sanctions, share more information and develop one space-related security policy
- UK go join EU PESCO project on military mobility, wey di aim na to speed up troop and equipment movement inside and outside di bloc
- Di goment say di agreement "pave di way" for UK-based arms firms to access di Security Action for Europe (Safe) - one £150bn EU fund wey dey provide loans for defence projects
Youth experience scheme
- UK and di EU don agree to co-operate further on one "youth experience scheme" - but dis go dey subject to further negotiations
- Goment say di scheme "go see how young pipo go fit work and travel freely for Europe again" but e go dey "capped and time-limited"
- Dem say di idea go mirror existing schemes di UK get wit kontris like Australia and New Zealand, wia annual quota of visas dey wey dey allow pipo between di ages of 18 and 35 to work for each oda kontris for up to three years
- UK also dey negotiate to rejoin di Erasmus+ programme, wey dey allow students to study or do internship abroad
Passport e-gates
- British holidaymakers go fit use e-gates for more European airports
- Wen Brexit end free movement, dem bin stop UK travellers from using EU e-gates. Now di EU Commission legal barrier no dey again wey go stop UK citizens from using dem afta dem roll-out dia long-awaited digital border checks system, wey go come into effect for October
- Each EU kontri go still decide if UK citizens fit use e-gates for dia ports but di goment don promise to work to expand access "as soon as possible"
- One new passport system go make am easier for UK pets to travel, dat go end di need for repeat vet certificates
Carbon and energy
- Di UK and EU go link dia carbon markets to avoid taxes on carbon-intensive goods like steel and cement wey dey travel between UK and EU
- Goment say e go save £800m in taxes and shield British steel from EU tariffs, thanks to one UK-only deal wey worth £25m a year
- UK go begin discussions on buying and selling directly into di EU shared electricity market but UK go need follow EU rules to seal a deal
Get in touch
Do you have any questions about the EU UK agreement? Get in touch.










